You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Mahamudu Bawumia congratulate John Mahama before Electoral Commission announce results

Di election process for Ghana continue on day two wit collation of results for presidential and parliamentary levels.

Summary

  • Mahamudu Bawumia concede defeat to John Mahama
  • Opposition NDC claim say dem dey lead
  • Voting end, collation and announcement of results start for Ghana election
  • Voters remain anxious sake of slow election process
  • Ghana presidential election 2024 result update

Live Coverage

Victor Ezeama, Komla Adom and Annette Arotiba

  1. Una bye-bye!

    Na here we go match break ontop our coverage of di Ghana election today.

    We continue to wait for di official declaration of results from di Electoral Commission even though di ruling party candidate don concede victory give di opposition candidate.

    EC say results suppose dey officially announced latest in 72 hours time - di chair Jane Mensa ask Ghanaians to exercise patience.

    Scroll down to catch up on all di reports and updates from Day 2 of our Ghana election 2024 coverage.

    Thank you for joining us and good night !

  2. Ghana go become di record fifth African nation to see opposition victory dis year

    Ghana go become di fifth African kontri on record wey di opposition party win election dis year if tins remain as dem be.

    Di Vice-President of Ghana Mahamudu Bawumia concede defeat for di election wey happun on Saturday.

    Im congratulate di opposition leader and former President John Mahama on im victory.

    Early results suggest say dis fit be one of di heaviest defeats in decades for di New Patriotic Party (NPP), wey bin dey power since 2016.

    Voters bin dey vex sake of many tins like, rising cost of living, series of high-profile scandals and a major debt crisis wey no allow goment deliver on key promises.

    Sake of dis, di NPP fit don drop below 45% of di presidential vote for di first time since 1996.

    Di vote for Ghana don end a remarkable 12 months in African politics, wey don see five transfer of power - more dan eva before.

    Dis era don also bring opposition victories for Botswana, Mauritius, Senegal and di self-declared republic of Somaliland.

    Even beyond dis results, almost evri election wey don happun for di region dis year under reasonably democratic conditions, di governing party don lose a significant number of seats.

    Sabi pipo say na a combination of factors like di economic downturn, growing public intolerance of corruption and di emergence of increasingly assertive and well-co-ordinated opposition parties dey cause dis trend.

    Di trend fit kontinu into 2025, and e go cause trouble for leaders like Malawian President Lazarus Chakwera, wey im kontri go do election for September.

  3. Ghana police arrest 12 suspects wey vandalise warehouse

    Ghana police say dem arrest 12 pipo for looting and causing damage to properties for some part of di kontri.

    According to di tok-tok pesin of di service ACP Grace Ansah-Akrofi, dia investigation show say di suspects bin attack and damage some state properties.

    Dis include di electoral commission office for Damongo constituency for di Savannah region.

    Di suspects also damage some houses of District Chief Executives for di kontri. Dem also destroy some collation centres.

    “Some of di suspects bin break into di school feeding warehouse for Tamale wey dem carry some of di foodstuff run away.”

    Di police also confam say dem get videos of di looting and attacks and dem dey review dem to make sure say di pipo go face di law.

    “We dey urge di public to remain calm as di police don deploy officers to key locations wit intensified patrols to maintain law and order,” ACP Grace Ansah-Akrofi add.

  4. Summary of Electoral Commission Chairman presser, She say make Ghanaians dey patient as na just 23 hours ago wey polls close

    Di Electoral Commission of Ghana Chairman Jean Mensah say result don come in from di Ahafo region and odas go begin come in from now.

    She add say di collation results dey start wit di pink sheets from di polling stations.

    Dis pink sheets na wia dem dey write di results wey all party agents accept and sign afta dem count di results from di polling stations.

    "Di pink sheets na di basis of di results wey dem dey announce" EC Chairpersin tok.

    All political parties dey collect dia own resullt sheets from di polling stations.

    She add say part of di reason for di delay of results be like dis na sake of di crowd and some jaguda pipo wey dey disturb di collation centres.

    She say for places wey dey almost impossible to collate results, di collation officers go proceed to collate di presidential results if di constituencies wey dem neva collate no go affect di outcome of di result.

    According to her, "di Commission put in place a robust mechanism." She tell Ghanians to dey patient. "Na just 23 hours since polls close make una dey patient"

    According to her di Commission no dey delay like dis as dem break record for 2020 wen dem announce result in 48 hours.

  5. Breaking, EC Chair Jean Mensa address di press

    EC Chair dey address di press on di process of di result announcement.

  6. Nigeria President Tinubu congratulate John Mahama

    Nigerian President Bola Tinubu don congratulate President elect John Mahama on im victory for di 7 December elections.

    Dis dey come afta vice president Muhamadu Bawumia concede defeat..

    Statement from di presidency say President Tinubu for call to Mahama tok say im hope for dis new presidency na ECOWAS stability as e renew im support say di bonds between Nigeria and Ghana go deepen.

    Di president hail Ghana for how dem take run di eleection and also hail Bawumia say im concede even bifor di Electoral Commission go announce di official results.

  7. National peace council commend Bawumia for respecting peace pact

    Di national peace council don tok say e sweet dem say di vice president and NPP presidential candidate bin concede defeat wia im accept results of di election.

    Inside one statement, di council explain say “di vice president try well well, say im respect im commitment to di presidential peace pact.”

    “Dis action don enhance di democracy of di kontri and we dey proud.”

    “We don congratulate Dr Bawumia for in acceptance of di results - as we wait for di electoral commission to officially declare di results, we also encourage all parties and dia supporters to remain calm and keep di peace.”

    All 12 presidential candidates on 28 November, sign one peace pact say dem go accept di results of di 2024 elections.

  8. Fotos from di National Collation Centre for Accra as pipo await official results

    Dis na some fotos from di National Collation Centre for Accra where di Electoral Commission still dey await results of di presidential election wey hold on Saturday 7 December.

    As at now, na only di result of one region, Ahafo region don reach di centre out of di 16 regions wey dey for Ghana.

  9. NDC chairman dey para as EC dey delay collation of results

    Chairman of di National Democratic Congress (NDC) Asiedu Nketia dey para as di Electoral Commission of Ghana dey waste time to begin declare di results.

    Di Chairman tell tori pipo say even if all di results neva come, make dem at least begin declare some of di ones wey don land.

  10. John Dumelo win Ayawaso West Wuogon

    Actor and businessman John Dumelo don win im contest to represent the people of Ayawaso West Wuogon constituency.

    Dis na afta im fight off stiff competition from di incumbent MP Lydia Alhassan John Dumelo bin dey try to win dis constituency since 2018, but im lose by close margin for di 2020 poll.

    But dis time, di actor-turn-farmer win wit plenti margin.

    Below na di break down of di votes.

    John Setor Dumelo (NDC) - 40,561

    Lydia Alhassan (NPP) - 27,377

    Abdul Rauf Abugri (independent) - 189

    • Total valid votes - 68,127
    • Total rejected ballot - 257
    • Total votes cast - 68,384
  11. EC say na di pink sheets go determine di final result

    Ghana Electoral Commission don tok say wetin go determine di final results na di 'pink sheets.'

    Dis na as di Vice President Mahamudu Bawumia don call to congratulate im opponent John Mahama.

    EC explain say, "na di pink sheets wey di 40,650 polling stations generate and wey di presiding officer and party agents sign go determine di final results".

    Dem add say, "feedback from di di field be say di results dey trickle enta di Regional Collation Centres."

  12. Ghana electoral commission say result neva reach di collation center

    Di Electoral Commission for Ghana say dem neva receive any results for di National Collation Centre yet.

    Dis na di latest from di Director of Electoral Services, Mr. Benjamin Bano-Bioh from di National Collation Centre.

    According to di director, e say informate from di field be say results still dey come in to di Regional Collation Centres, and di Commission no fit publish any results yet.

    Di electoral services director also say di reason why di delay bin dey be say some of di Constituency Collation Centres dey attacked, wit destruction of election materials.

    Di director also clear say na wen dem receive di results from all di 16 regions bifor dem go begin announce and publish am.

    Meanwhile, local media dey report say touts set ballot materials ablaze and also lock up media pipo for Techiman South of di kontri.

  13. Looters attack Assembly and Agric warehouse for Tamale

    Looting of ware houses dey go on for Tamale.

    Di tori be say di looting dey go on for two separate locations wey be di assembly warehouse and Agric warehouse.

  14. Railways minister John Peter Amewu lose Hohoe constituency seat

    Di minister for railways development oga John Peter Amewu don lose im seat for Volta region.

    Di Hohoe seat na di only seat wey di goment party don win for di region in di 2020 elections out of 18 seats.

    Dis na di stronghold of di NDC.

    But afta di yesterday voting, dat seat also don comot dia hands.

    According to di results from di EC returning officer for di constituency, dis na di breakdown;

    • John Peter Amewu (NPP) - 14,971
    • Thomas Worlanyi Tsekpo (NDC) - 31,163
    • Esther Amewor (NDP) - 55
    • Stephen Dzidefo Adzraku (PNC) - 39

    Rejected ballots - 314

    Total votes cast - 46,542

    Total valid votes - 46,228

  15. US embassy for Ghana congratulate di kontri for ‘successful elections’

    Di US embassy for Ghana don congratulate Ghanaians say dem conduct “successful elections for di kontri wia reflect di will of di pipo.”

    For one statement for dia social media page dem tok say “di US dey look forward to kontinu our strong partnership under John Dramani Mahama.”

    Dem add say “we don commend all di candidates wey contest for dis election and dia commitment to peaceful elections and di transfer of power as di vice president Dr Bawumia tok for im concession speech.”

  16. Nigeria former VP Atiku Abubakar congratulate Mahama

    Di 2023 Nigeria presidential candidate of di Peoples Democratic Party (PDP) Atiku Abubakar don send congratulatory message to John Mahama of di National Democratic Congress (NDC).

    Dis na sake of di jubilation wey don dey go on for Ghana afta di ruling New Patriotic Party (NPP) Mahamudu Bawumia bin concede defeat to di opposition for di 2024 presidential election.

    "Your Excellency, Mr President-elect John Mahama. My warmest congratulations on your victory."

    "Dem tell me say you dey on your way to church and I bin wan catch up wit you bifor you enta di church for di Sunday service," Atiku tok.

    Meanwhile, di Ghana electoral commission neva begin announcement of results for di Ghana elections 2024.

  17. Trade minister K.T Hammond lose Adansi Asokwa seat for Ashanti Region

    Minister of trade, Kwabena Tahiru Hammond don lose di Adansi Asokwa seat for di Ashanti region.

    Oga K.T Hammond na popular pesin for dis goment wia im be one of di senior lawmakers for parliament.

    But afta di election, im join oda goment ministers to lose dia seats.

    Result show;

    • KT Hammond (NPP) - 13,275
    • Godwin Dorgbadzi (NDC) - 14,229
    • Justice Mensah (CPP) - 346

    Rejected votes - 457

    Total votes cast - 28,307

    Total valid votes - 27,850

  18. John Dramani Mahama acknowledge congratulatory call from Mahamudu Bawumia

    John Dramani Mahama, flag-bearer candidate of National Democratic Congress (NDC) don accept di congratulatory call from im opposition Mahamudu Bawumia of New Patriotic Party (NPP) on Sunday.

    Oga Mahama tank di Ghana pipo for voting for am during di Saturday’s election.

    "Dis morning, I don receive congratulatory call from my brother Dr @MBawumia, following my emphatic victory for di Saturday election. Thank you, Ghana," e tok for im Twitter page.

    On Sunday, Di Vice President of Ghana wey also be di candidate of di NPP Mahamudu Bawumia concede to defeat during one press briefing afta di general elections for Ghana.

  19. Movement for change presidential candidate Alan Kyerematen congratulate Mahama

    Di presidential candidate of di Movement for Change party in Ghana, Alan John Kwadwo Kyerematen don send congratulobia to former President John Dramani Mahama.

    Dis dey come afta di ruling New Patriotic Party (NPP), Mahamudu Bawumia bin concede defeat to di opposition National Democratic Congress (NDC) for di 2024 presidential election.

    Although di Ghana Electoral Commission neva give any official announcement of results, but congratulation don dey pour in for Mahama.

    According to Kyerematen, e say e dey clear say Ghana bin speak wit dia votes.

    "I go like to congratulate former President John Dramani Mahama and di National Democratic Congress (NDC) for an emphatic victory for di just concluded 2024 General Elections."

    "I dey urge all Ghanaians to accept di decision of di Ghanaian electorate once di official results dey released so as to preserve di peace of our dear nation," Kyeretan say.

  20. Health minister Dr Bernard Oko Boye lose Ledzokuku constituency seat

    Di latest cabinet minister to lose im seat for dis Ghana election na Dr Bernard Okoe Boye.

    Di president don appoint Dr Okoe-Boye in February dis year afta im sack den minister Kweku Agyemang Manu.

    Bifor im appointment na im be di boss of di kontris national health insurance scheme.

    But afta di 2024 poll, im lose di seat to opposition NDC candidate Ayiku Benjamin Narteh.

    Di result wey di returning officer announce na;

    • Dr Bernard Okoe-Boye (NPP) - 19,866
    • Ayiku Benjamin Narteh (NDC) - 23,913

    Rejected votes - 230

    Total votes cast - 44,307