79"
Salah and di Egypt players gada around di ref dey complain say di ball na foul ball. VAR go check am. Dem also dey check for OFFSIDE!
You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Morocco defeat Nigeria 4-2 on penalties to reach Afcon 2025 final.
Komla Adom, Tamara Ebiwei, Helen Oyibo
79"
Salah and di Egypt players gada around di ref dey complain say di ball na foul ball. VAR go check am. Dem also dey check for OFFSIDE!
77"
Senegal get dia goal. Sadio Mane benefit for one confusion for di front of di Egypt box to strike di ball hard. E don beat El Shenaawy wey e enta di goal.
76"
For di past few seconds, Senegal get all di possession. Camara ghost behind di Egypt defence to cross one ball into di box, but goalie El Shenaawy catch am.
74"
Egypt no get any shot on target yet, same as Senegal. 25 mins more for one of dis teams to get a goal, odawise di game go enta extra time.
72"
Senegal bin get corner kick. Malick Diouf kick di ball e finally fall to NDiaye but his final ball go wide. He don vex wey he dey ask for beta kicks into di box.
71"
Jackson try to hold di ball wey he pass to Mane for di far left of di Egypt area. Di ball don comot for throw-in now.
70"
Trezeguet don foul Ndiaye close to di center line. Ref blow whistle wey he warn di Egypt player to dey careful.
69"
Ndiaye beat Trezeguet to enta di Egypt box, he try to slide di ball to his teammate but dem clear di ball. Senegal get possession again. Dem dey pass pass di ball among diaserf bifor dem give de ball to Mane. Las las di ball spoil wey Egypt try to counter but Senegal don clear dia line.
67"
Idrisa Gana Gueye don drag Marmoush for di centre area. Ref call for freekick. Egypt bin dey try to launch counter attack bifor.
66"
Ashour don foul Diatta for di Senegal area, di first time Egypt don penetrate to reach di opponent box for di second half so far.
64"
Sadio Mane pass di ball to Diatta, his shot dey blocked, bifor di ball reach Ndiaye. He pass to Camara but his cross into di area no troublke anybody. El Shenaawy catch di ball for air.
63"
Foul against Mohamed Salah. He try to beat Diouf di defender wey di player stop am. Salah no get any oda option dan to foul him.
61"
Senegal get freekick. Diakhite try to meet di freekick inside di Egypt box but El Shenaaawy catch am wit two hands.
58"
Trezeguet use elbow chok Pape Gueye wey he fall for ground. VAR check wey dem tok di ref inside his ears say e neva be foul. From di freekick, Senegal almost create sometin - again, Egypt don clear any danger.
56"
Senegal dey try to create sometin, but di Egypt defence make kankpe.
53"
Diatta try to cross one ball inside di Egypt area but di ball don spoil.
50"
Ashour tink say he don win freekick for di throw but ref say make he rise up and play di game
48"
Egypt try to create sometin. Trezeguet begin di attack for di back bifor dem play di ball across di filed to Salah but di Liverpool man delay wey he carry di ball go back to his teammate.
47"
Tins don slow well well. Everibodi dey use play di game. Nobody wan rush to make mistake.
46"
Senegal goalkeeper wey be spectator for di whole first half now get to touch di ball as Senegal begin to pass di ball for din back. Na so di ball dey move among di green shirts behind di halfway line.