Di US presidential election wey go decide who go take-ova di White House don alreadi dey witness tight race.
But e dey possible say di candidate wey get di higher votes no go be di winner.
Dis na sake of say no be voters dey choose directly who go be president, na wetin dem dey call electoral college dey choose am.
How electoral college dey work?
Wen Americans do di presidential election, di votes go only go up to make-up one group of officials wey go represent Kamala Harris or Donald Trump for electoral college.
Electoral college- simply mean group of pipo wey get shared task to do for election.
Dis pipo na electors and dia job na to choose who go be president and vice president.
E mean say na number of electors from each state dey roughly make up di population and each States get many electors as dem get lawmakers.
Di total number of electors na 538.
Interestingly, each elector dey represent one electoral vote and candidate need to get 270 or more votes to win di presidency.
For di oda hand, states dey award all dia electoral college votes to di candidate wey win votes of ordinary voters for di state.
Wit dis system, di popular vote winner fit loose di election