Limit your protest to Moshood Abiola Stadium - Wike
"Limit your activities to di Moshood Abiola Stadium in line wit di order of di court," na so FCT Minister Nyesom Wike tell protesters wey turn out for di end bad governance for di kontri capital on Thursday, 1 August.
E say some protesters bin try to scata Eagle square for Abuja, but security agencies stop dem, e tell protesters say make dem no carry dia demonstration pass di confined area.
“Available intelligence show say some protesters dey plan to cause destruction of properties wey fit lead to di loss of lives of di city and security agencies no go allow am,” im tok
Di FCT minister also allege say na one Senator dey sponsor di protesters against di goment. Wike add say security agencies go soon invite di Senator for questioning.
“We get intelligence say na one senator dey provide food to di protesters. Dat na sponsorship... for a Senator to provide food for protesters.
“Di security agencies go invite di senator and find out how you go dey sponsor dis kain tin against di goment of di day,” Wike tok.
Oga Wike give dis informate as e dey follow tori pipo tok for Abuja on Thursday.
E say di goment no dey stop protest, dem only dey beg pipo to give gomet some time to address di challenges di kontri dey face.