You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Evritin wey happun as Nigerians enta street to protest on her 64th Independence Day

Reactions from across Nigeria as pipo enter street to protest on October 1st Nigeria Independence Day anniversary.

Summary

Live Coverage

Helen Oyibo, Annette Arotiba, Victor Ezeama

  1. President Tinubu touch on di youth, security and economy for im Independence Day broadcast, To put togeda a 30-Day National Youth Confab

    Meanwhile, Nigeria President Bola Tinubu don announce di gathering of a National Youth Conference to address di different challenges and opportunities wey dey face young pipo for di kontri.

    President Tinubu tok wen im address di nation for im second Independence Day Broadcast and Nigeria 64th anniversary say di conference go "provoke meaningful dialogue and empower our young pipo to participate actively in nation-building."

    E say dis go dey possible by by ensuring say dia voices dey heard in shaping di policies wey dey impact dia lives.

    Di Confab go last for 30 days and e go touch on issues like education, employment, innovation, security, and social justice.

    Di president add for im address say di details of di Confab and selection of di delegates go dey designed in close consultation with di young pipo through dia representatives.

    Oda youth-centric programmes wey di president say di administration dey do na di 3 million Technical Talents programme (3MTT) of di Ministry of Communications, Innovation and Digital Economy, wey dey aimed at building Nigeria technical talent.

  2. Protesters don gada for Lagos

    Protesters don gada for Lagos as early as around 8:00am to begin dey demonstrate.

    Di protesters gada for Ikeja area of di state.

    Police bin dey ground as di protesters gada dey demonstrate.

  3. Una good morning!

    Welcome to our live page today.

    We go dey cover the Nigeria October 1st protest lie from across di kontri plus di kontri 64th Independence Day celebration and reactions to Presdient Bola Tinubu broadcast.

    Thank you and welcome!