You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

APC candidate senator Monday Okpebholo become Edo govnor-elect

Live updates from Edo state as Inec dey ready to announce results from di Saturday govnorship poll.

Summary

  • Inec don resume for Edo state collation centre
  • PDP members dey protest outside INEC office for Benin
  • Security dey beefed up for Inec collation centre afta Obaseki drama
  • Inec say dem go begin announce results by 10:00am
  • Security agents escort Edo state Govnor Godwin Obaseki out of collation centre

Live Coverage

Helen Oyibo, Annette Arotiba

  1. Graphic breakdown of how PDP win Igueben

  2. Breaking, PDP win Igueben local goment area

    PDP win Igueben local government area with 8,470 votes.

    Breakdown of di oda top two dey below:

    APC: 5907

    LP: 494

  3. Meet Edo state govnorship 2024 election Returning Officer

    Di Returning Officer for di Edo 2024 govrnorship elections na Professor Farouk Adamu Musa, Vice Chancellor of Federal University of Technology, Minna, Niger State.

  4. Breaking, Inec don resume Edo collation centre

    Inec don resume Edo state collation centre more dan 1:30 minutes afta dem say dem go begin.

    Di Edo state govnorship election happun on Saturday and pipo bin don dey ginger for Inec to begin collate di results.

  5. Why I go Inec collation centre – Obaseki

    Edo State Govnor Godwin Obaseki don give reason why im waka go Inec collation centre for middle of di night afta Inec no proceed with collation of election results without giving any reason.

    Obaseki for one press briefing wit tori pipo for Benin say, im bin receive informate say as at 1:00am, dem Inec, no allow PDP party agents to enta di collation centre, and dem no give any information on wetin go be di next move afta voting end.

    “I bin get report around 1:00am say dem bin move collation go Inec head office. I bin also get report from our agents say dem no allow PDP agents enta di collation process. Na den I call di REC to find explanation on wetin dey happun. Im no respond, Obaseki tok.

    Di govnor say as im no get any response from di Rec na im e kuku waka go di centre to take im eye see how far.

    E say even though di Rec still no gree see am to tok wetin dey happun, Deputy Inspector General of Police, Frank Mbah na im come speak to am.

    According to di Nigeria electoral Act, to ensure transparency, Inec suppose inform di public on di processes as dem dey occur. Obaseki say dis na wetin im bin dey expect and na why im waka go dia for 2:00am.

    Di govnor allede say, na afta im meeting wit Mbah, na im Inec release statement around 5:00am to give update on di process

  6. Resident Electoral Commissioner for di Edo govnorship election don land di collation centre

    Di Resident Electoral Commissioner for di Edo state govnorship election Onuoha Anugbum, don land di collation center.

    Di collation exercise for di state level dey expected to start any moment from now.

    Meanwhile, heavily armed policemen don secure di venue of di Inec state collation center.

    Oda security agencies like Civil defence, DSS, Immigration, EFCC and FRSC dey ground to provide security for di collation center.

    Di collation center dey filled wit presence of party agents, observers and different media organizations.

    Some local governments collation officers don already dey for di Inec state office.

  7. Inec say dem don upload results from di 192 wards for IReV

    Di Independent National Electoral Commission (Inec) say dem don ready to start di state-level collation, as collation of results don end for most of di local goment areas of Edo state.

    Inec say dem don activate di INEC Result Viewing (IReV) portal and don upload di results wey dem collate from all di 192 wards.

    Di commission for statement add say, di designated officials go don land di state collation centre for Benin City, di Edo state capital or dem fit dey on dia way to commence di collation exercise.

    Inec also react to di gbege wey happun for di collation centre for di middle of di night wen Govnor Obaseki bin show for di place and how APC supporters boo am.

    “We also dey disturbed by di overnight presence and demonstration by some political actors plus dia supporters for our state head office ahead of di commencement of di final collation. Dis actions dey uncalled for. Make nobody disrupt di process at any state and no one go dey allowed to benefit from lawlessness.” Inec tok for statement.

    Dem add say process dey for addressing complaints during collation, wey include di power to review results declared under duress. “Di commission no go hesitate to involve such powers where necessary,” dem add.

    Inec say accredited party agents, observers plus di media suppose get free access to all collation centres and call on security agencies to continue dey maintain di same vigilance and professionalism wey go lead to di peaceful conduct of di election as dem conclude di process.

  8. Police beef up security for Edo state INEC collation centre

    Di Nigeria Police Force don deploy more security personnel go di Edo state Independent National Electoral Commission collation centre, as more results dey expected to arrive di collation centre later today.

    Dis dey come afta di gbege wey happun wen Edo state Govnor, Godwin Obaseki bin turn up for di collation centre for di middle of di night.

    Im arrival for there no go down well wit supporters of di opposition party, APC as dem begin clamour say e must comot for di place.

    Police later escort di govnor comot di centre bifor di mata get out of hand.

  9. Watch: Moment police escort Govnor Godwin Obaseki comot from di collation centre, Govnor Obaseki bin show for di middle of di night

    Plenty police officers bin escort Edo state Govnor Godwin Obaseki comot from di Inec state collation centre early mor-mor on Sunday.

    Dis dey come afta di govnor go di collation centre around 3:00am for di middle of di night bifor di announcement of di govnorship election wey hold on Saturday, 21 September.

    E neva clear why e go there, but e dey come afta tori of allegations of rigging, wey PDP di ruling party for di state accuse some officials of di electoral commission.

    Im presence for di state attract reaction from supporters of di opposition party, APC wey bin dey ground and dem begin chant and boo am say make e comot di place

    Dem condemn im presence for di collation centre and call on security agents to remove am from there.

    Following wetin happun for midnight, police don deploy more security forces go di collation centre as more results go arrive di center today.

    Di Resident Electoral Commissioner Anugbum Onuoha bin announce say collation of results for di Edo governorship election go start by 10:00 am on Sunday.

  10. Inec to open collation centre 10:00am today

    Di Edo state govnorship election happun on Saturday 21 September, 2024.

    Dis na a break down of wetin don happun so far.

    Di accreditation and voting bin start late for some polling areas due to logistics issues wey happun wen some adhoc officials no quickly move go dia polling units.

    However, despite di heavy rain wey fall for different parts of Edo state during di voting process, di voters no gree comot until dem cast dia votes.

    For around 2:30pm, Inec announce say make dem extend voting time for places wey dem no quick begin voting.

    Meanwhile, BBC Pidgin bin monitor how voting bin go for some local govment areas within di state and also how some candidates bin vote.

    By di time wey voting end, e no too tey wey counting begin and voters stay wit dia votes to count am for polling units.

    Meanwhile, for places wey some gbege dey wey election voting no end well, Inec say dem go investigate am and take decisions.

    For Inec collation center, some RAC centers bin arrive late in di night while some neva count finish.

    Inec no begin collation and announcement of local govment results until dem announce postponement go Sunday 22 September by 10am.

    For di oda hand, small drama happun overnight wen Govnor Godwin Obaseki bin visit di Inec office for Benin city for middle of di night, but di opposition protest say make e comot.

    Results announcement go begin wen Inec open di state collation center by 10:00am today.

  11. Una good morning!

    Welcome to our live coverage of di Edo state govnorship election today.

    In case you miss our election live coverage, check am out here.

    Una welcome!