Bola Tinubu
tell Nigerians say tins no go always dey smooth wen im become president of di
kontri.
Di
President-elect tok dis afta im collect di kontri highest national honour from
Muhammadu Buhari for Abuja on Thursday.
On 25 May, president
Buhari bin give Tinubu di title of Grand commander of di Federal Republic
(GCFR).
Im vice
president elect Kashim Shettima also collect Grand commander of di order of di
Niger (GCON).
“Our way no
go always dey smooth. Yet we get faith for our plan and belief for our
collective ability to overcome di challenges wey confront us.” Tinubu tok
But di
President-elect assure kontri pipo say im no go disappoint dem.
“I must run
dis race and must do it well. On security, di economy, agriculture, jobs,
education, health and power and for all oda sectors we must make headway. Di
pipo deserve no less. For this, I no go disappoint neither them nor you, Mr.
President.” Tinubu bin add.
“I be simple
man wey benefit from di support and goodwill of di people of Nigeria. Di pipo
put dia trust in us. You don do your part, Mr. President.’’
President
Buhari also hand di transition documents and di baton of service to di incoming
president for di event.
Tinubu bin hail
Buhari for im speech and torchlight some of di tins wey di outgoing president
administration do.