You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Goment say flooding for Nigeria don kill more dan 600 pipo

Authorities for Nigeria say di number of pipo wey don die as a result of flooding across di kontri don rise to at least 603 and more than 1.3 million odas dey displaced.

Live Coverage

Jelilat Olawale

  1. Buhari don approve 12,000 metric tonnes of food to affected states

    Nigeria President, Muhammadu Buhari don approve di release of 12,000 metric tonnes of food items from di National Strategic Reserve.

    Dis na for distribution to communities wey dey affected by flooding across di kontri.

    National Emergency Management Agency don begin di transportation of dis items to di affected States.

  2. Over 600 pipo don die

    Authorities for Nigeria say di number of pipo wey don die as a result of flooding across di kontri don rise to at least six-hundred and three and more than 1.3 million odas dey displaced.

    Minister of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development Sadiya Umar Farouk na im give dis update

  3. Welcome!

    Una welcome to BBC Pidgin coverage of floods situation for Nigeria.

    We go dey bring you update as floods continue to ravage di West African kontri.