You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Gabriel Jesus, Xhaka and Partey goals hand Arsenal victory over 10-man Tottenham

Premier League leaders Arsenal welcome North London rivals Tottenham to Emirates Stadium for Matchday 9.

Live Coverage

Moseph Ekine

  1. Thank you!, FT: Arsenal 3-1 Tottenham

    Na here we go end our live update of di Premier League match wey see Arsenal defeat Tottenham 3-1.

    Di victory ensure di gunners maintain top spot for Premier League wit 21 points afta eight matches.

    We thank you for reading all our updates, make you scroll down to see how di match go incase you miss am. Bye!

  2. 'I no wan tok about di red card', FT: Arsenal 3-1 Tottenham

    "I tink di first half bin dey in di balance. We bin get many chances to score. We make big mistake with di last pass becos we bin get great space. For di second half we concede second goal early and we for fit do much better," na so Tottenham coach Antonio Conte tok afta di game.

    "Wit di red card, di game [comot from our hand]. Di game bin dey really difficult afta dat. We come need to change totally then. [Di red card] na di referee decision and I no want comment.

  3. 'We no start well', FT: Arsenal 3-1 Tottenham

    Tottenham Eric Dier say Spurs bin no start well but dem need to go again.

    For interview wit BT Sport im say: "Dem [Arsenal] start better in both halves, and score a good goal from outside di box. Afta dat we come improve, we get to 1-1 but lack quality in di final pass.

    "Same again for di second half. We no start well, concede poor goal afta di sending off and e bin dey difficult.

    "Wen e bin dey 2-1 at dat point dem score straight away again. We bin no fit really organise ourselves before dem score di third.

    "Dis na di beginning of di season so e no really be big blow. E dey disappointing, of course, but we lose here for di start of last season as well and build again and enjoy good finish. I dey sure we fit do di same and go again dis year."

  4. 'From di first second we be di better team', FT: Arsenal 3-1 Tottenham

    Afta di game Arsenal midfielder Granit Xhaka tell BT Sport say:"We bin no get a lot of weeks to prepare becos of di international break, but we see for yesterday training say we dey ready.

    "From di first second I tink na we be di better team. Afta we concede we struggle a little bit, but for di second half we improve and I dey so happy to score and help di team to win. My first derby goal for England. I dey more than happy to help di ieam. Di team na di most important tin."

  5. Full-time, Arsenal 3-1 Tottenham

    Arsenal emerge winners of di 192nd North London derby.

    Partey first half strike open di scoring for di home side before Kane equalise from di spot.

    Jesus restore Arsenal lead early for second half before Spurs go down to 10-men as Emerson Royal receive red for foul on Martinelli.

    Granit Xhaka add Arsenal third wit left footed strike on 67 minutes.

  6. , 90+2 mins

    Arsenal 3-1 Tottenham

    Spurs players look like team wey don give up already.

    Dier don receive yellow card as im pull back Nketiah.

  7. , 90 mins

    Arsenal 3-1 Tottenham

    Lloris stretch fully to stop Tierney shot from outside di box.

    Di Gunners camp for di visitors half as di referee don add three minutes before full time.

  8. SUBSTITUTION

    Arsenal 3-1 Tottenham

    Arsenal make dia final subsitution. Ben White wave di fans as im come off for Takehiro Tomiyasu.

  9. , 85 mins

    Arsenal 3-1 Tottenham

    Martinelli receive yellow card for im late challenge on Doherty.

  10. , 80 mins

    SUBSTITUTIONS

    Arsenal 3-1 Tottenham

    Arsenal make double change.

    Eddie Nketiah and Vieira don enta di pitch in place of Jesus and Odegaard.

    Di Gunners still get one more change to make but Spurs don complete dia substitutions.

  11. , 77 mins

    Arsenal 3-1 Tottenham

    William Saliba receive yellow card as im try to stop Bentancur.

    Just before di foul, Spurs bin send on Oliver Skipp for Pierre Emile Hojbjerg.

  12. , 73 mins

    SUBSTITUTIONS

    Arsenal 3-1 Tottenham

    Arsenal make dia own changes.

    Tierney and Lokonga don come on for Partey and Zinchenko.

  13. , 71 mins

    SUBSTITUTIONS

    Arsenal 3-1 Tottenham

    Yves Bissouma, Davinson Sanchez, Ryan Sessegnon and Matt Doherty all don come on for Tottenham.

    Son Heung-min, Richarlison, Ivan Perisic and Clement Lenglet don go off.

  14. Breaking, , Arsenal 3-1 Tottenham

    GOAL!

    Arsenal increase dia lead through Granit Xhaka.

    Di Swiss take control of Martinelli lay off come fire left footed shot beyond Hugo Lloris reach.

  15. , 66 mins

    Arsenal 2-1 Tottenham

    Bukayo Saka left foot curler from just outside di box fizzle wide.

  16. Breaking, Red Card!

    Emerson Royal stamp on Martinelli don see di right back collect red card.

    Di defender no believe im eyes wen referee Anthony Taylor show am di card.

    Conte disagree wit Taylor but di referee stand wit im decision.

    Spurs down to 10-men.

  17. , 60 mins

    Arsenal 2-1 Tottenham

    Jesus again wit anoda header to trouble Lloris.

    Even though di Frenchman save di shot on target, di linesman bi don flag for offside.

  18. , 52 mins

    CLOSE!

    Arsenal 2-1 Tottenham

    Bukayo Saka link up wit Ben White and im pull di ball back to Gabriel Jesus but im header no dey on target as e go wide. Another huge chance for Arsenal!

  19. Breaking, , Arsenal 2-1 Tottenham

    GOAL!

    Arsenal retake di lead through Gabriel Jesus.

    Di Spurs goalkeeper no fit hold Bukayo Skak shot as im mistakenly spill di ball wey allow Jesus to beat Emerson Royal and poke am over di line.

    Arsenal don go back in front.

  20. , Arsenal 1-1 Tottenham

    46 mins

    Di players don return to di pitch as di second-half dey set to start.

    Arsenal na dem go restart play.