Some 2,000 pipo dey expected to attend di Queen state funeral later, and dis go be di biggest gatherings of royalty and politicians hosted in di UK for decades.
No official guest list don dey published, but dis na wetin we know about who go attend and who no go attend at 11am service for Westminster Abbey.
Members of royal families from across Europe go attend di funeral. Dis include di kings and queens of Belgium, di Netherlands and Spain.
Japan's Emperor Naruhito and Empress Masako dey attend di funeral too.
US President Joe Biden and First Lady Jill Biden don travel to London for di funeral. Oda world leaders wey we expect to see dis morning na French President Emmanuel Macron, Australian Prime Minister Anthony Albanese and Canadian Prime Minister Justin Trudeau.
Leaders from many oda Commonwealth nations go also attend. South Africa and Kenya Presidents Cyril Ramaphosa and William Ruto don arrive
Dem no invite Russia, Belarus and Syria.
UK politicians and officials
Many familiar faces from British public life go dey dia.
Prime Minister Liz Truss, wey di Queen appoint just two days before she die, don dey go di abbey wit oda goment figures. Opposition politicians, leaders of di UK goments and many oda public officials.
Charities, sport, arts and science
We also expect to see representatives from charities wey di Queen bin support. Recipients of di Victoria Cross and George Cross go also attend.
Famous faces dey expected to attend di funeral.