Nigeria international Chidera Ejuke don become di latest African footballer to leave di Russian Premier League sake of di ongoing invasion of Ukraine.
Di 24-year-old winger don take advantage of Fifa ruling wey allow foreign players to comot di kontri and don suspend im contract wit CSKA Moscow until 30 June 2023.
Ejuke, wey im deal go expire for di end of June 2024, don score 10 goals and provide eight assists inside 65 appearances for CSKA Moscow since e join from Dutch side Heerenveen for 2020.
One of Ejuke advisers say di reason why im move be sake of progress for im career.
But e no gree comment on reports say di Super Eagle player dey set to join one German club on loan.
"E be one important decision for Ejuke to go place where im fit continue to make career progress," di adviser tell BBC Sport Africa.
"E bin start well for di national team but don fall since di pecking order and di new new Nigeria coach no look im side.
"If e move somewhere and play regularly, e fit hopefully get back to di national team and continue im development."
Ejuke has been capped eight times by Nigeria since making his debut in a 1-1 friendly draw with Tunisia in October 2020, and he made two appearances at this year's Africa Cup of Nations as the Super Eagles exited in the last 16.
However, Ejuke dey overlooked by di three-time African champions for di two-legged 2022 World Cup play-off against Ghana for March.
And new coach Jose Peseiro no select am for di first two qualifying matches for di 2023 Nations Cup.
CSKA Moscow confam say dem suspend Ejuke deal, but add say dem plan to "defend dia interests against Fifa decision".
Di 13-time Russian champions consider "discriminatory and contrary" to di world governing body statutes.
Back in March, Fifa bin announce say foreign footballers wey dey play for Russia fit suspend dia contracts and temporarily comot for di kontri.
Di move come afta Russia clubs and national sides dey suspended from all competitions "until further notice" by Fifa and Uefa.