Di All Progressives Congress, APC for Rivers State don lose many of di party big wigs as over 10 party stalwarts don tender resignation letter from di party.
Some wey don resign include Dawari George, former govnorship aspirant and House of Reps member, former Acting Managing Director of NDDC Ibim Semenitari,
Former govnorship aspirant Prince Tonye Princewill, former member Rivers State House of Assembly, Golden Chioma, Chidi Wihioka among many odas wey dia resignation happUn within di past five days make pipo dey wonder wetin dey happUn.
While most of dem no give reason why dem comot, some like Chidi Wihioka say na becos dem no value im contributions to di party while odas like Prince Tonye Princewill say di reason e comot na becos e no happy with di Muslim-Muslim presidential ticket of di party as e dey insensitive and e no good for good governance.
As at now, di ones wey don comot never tok weda dem go join anoda political party.
Di leader of di party for Rivers State and former presidential aspirant of di APC, Chibuike Rotimi Amaechi never react to di recent resignations.