'I bin lose track of time' - Tobi Adegboyega tok about UK deportation and SPAC Nation allegations
Pastor Tobi Adegboyega, founder of di Salvation Proclaimers Anointed Church (SPAC Nation) don tok ontop di allegations wey dey against am.
For dis interview wit BBC, Pastor Adegboyega tok say im come di UK wen im be 25 years old boy.
Adegboyega bin lose im appeal with di goment of United Kingdom to remain within di kontri territory as legal resident.
UK immigration tribunal dismiss di appeal by di Nigerian pastor, to continue im stay for UK to attend to family and oda activities.
Adegboyega say im no go move im organisation come Nigeria sake of say na UK e dey and e also dey evriwia too.
E say im go establish more of di movement.
Reactions bin follow di tribunal ruling as local media begin report say di UK wan deport Pastor Adegboyega.
But Dele Olawanle, legal representative to Pastor Adegboyega say reports on social media wey say im client dey face deportation for UK na false and e no go make any further statement on di issue of deportation.
"Deportation na for criminals. E no be…" di lawyer tok.
Olawanle tok say di court no find im client guilty of any "wrongdoings" as regard SPAC Nation alleged illegalities.





