Why Kenya declare 13 November public holiday to plant trees

Wia dis foto come from, Getty Images
Kenya give her kontri pipo special holiday on 13 November, 2023 to plant 100 million trees as part of goment target to plant 15 billion trees inside 10 years.
Dis holiday go allow every Kenya pesin to “own the initiative", according to di Environment Minister, Soipan Tuya.
Authorities dey encourage each Kenya pesin to plant at least two seeds, wey go lead to di 100-million target.
About 150 million seeds dey ground already for public nurseries wey pipo fit go collect.
Goment dey provide di seeds for free for im forest agency centres wey Kenya pipo suppose plant for public areas wey goment don choose already.
But dem still encourage di kontri pipo to buy at least two seeds to plant for dia own land.
President William Ruto dey lead di tree planting exercise for Makueni for di east of di kontri.
Dem also send cabinet ministers go oda regions to lead di process wit county govnors.
End of Di one wey oda users dey read well well
Na through one internet app dem go take monitor di tree planting exercise by allowing individuals and organisations to record activities, including di kain tree wey dem plant, di number and date wey dem plant am.

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Jaza Miti app go also help pipo plant di correct seeds by making sure say di location wia dem dey plant di seed match wit di kain tree wey goment wan plant dia, according to di environment ministry.
Ms Tuya tell local tori pipo Citizen TV on Sunday night say pipo response so far dey "amazing" and say dem don already get two million registrations for di app by Sunday.
She however say e no go happun for di north-eastern region, wia flood dey worry.
Di kontri dey currently struggle wit heavy El Niño rain wey don kill plenty pipo, displace thousands plus damage tins – di north dey affected pass.
Kenya pipo generally welcome di tree-planting initiative while dem also dey tok about some of di challenges.
Environmentalist Teresa Muthoni tell BBC say di initiative na "very good idea", but say dem no organise di exercise im di way wey go make sure say everybody go go out to plant tree.

Wia dis foto come from, Getty Images
She say "many pipo don continue wit dia work to put food for dia table... dis dey occur for time wey di economy tie wrapper so plenty pipo dey struggle financially".
She also add say, "many of di 150 million trees available" wey dey for public nurseries dey strange.
"E dey very important to plant di right trees for di right place," she tok.
Di goment don also chop accuse say im dey campaign for tree planting but fail to control illegal cutting of trees for public forests – recently dem lift ban on tree cutting.
But on Sunday, di minister defend dia decision, saying na only forests wey dem keep for commercial purpose dey affected – dis na about 5% of di total.
She say dis dey necessary to feed di local wood demand and create jobs. E add say goment dey take action against pipo wey dey cut trees illegally for oda forests.
She say di tree planting campaign go help tackle food security and also "improve against climate change" to address di continuous drought and floods for di kontri.
Madam Tuya say dis exercise go continue even afta di special holiday and she expect say dem go don plant 500 million trees by di end of di rainy season for December.













