Wetin be di Joint Arab-Islamic Summit wey President Bola Tinubu dey attend

Published
Read am in 4 mins

All attention dey for Riyadh, di Saudi Arabia capital, as leaders from di Arab and Islamic world dey prepare to do di second Joint Arab-Islamic Summit on Monday 11 November.

Nigeria President Bola Tinubu plus oda leaders wey go follow participate for di summit, land di Saudi capital on Sunday.

Di Joint Arab-Islamic Summit na important gathering wey dey bring leaders and ogbonge pipo from di Organization of Islamic Cooperation (OIC) and di League of Arab States.

Di first Joint Arab-Islamic Extraordinary Summit bin happun on 11 November 2023, to address di kasala wey dey happun for Gaza, plus di border wahala wey dey worry di region.

Saudi Arabia use im leadership inside both di Arab League and di Organization of Islamic Cooperation (OIC), take mobilise diplomatic efforts through di joint summit to address di humanitarian plus security challenges wey Palestinians and neighboring states dey face.

Wetin Tinubu go tok for di summit

According to di Special Adviser Information and Strategy to President Tinubu: "During di summit, President Tinubu dey expected to address di ongoing Israel-Palestinian kasala.

Im go also emphasis Nigeria strong call for immediate ceasefire and di urgent need for peaceful resolution," di Presidency tok for statement.

Di first extraordinary summit, wey bin happun for Riyadh, Saudi Arabia, for 2023, bin adopt di resolutions wey condemn di Israeli aggression against Palestinians.

E call for immediate ceasefire and renewed efforts wey go make dem achieve two-state solution.

Di summit also emphasized di need for humanitarian aid and international support for di pipo of Palestine

Na King Salman and Crown Prince Mohammed bin Salman dey host di summit and e dey happun for di same city of Saudi wey e happun last year.

Agenda

Di agenda for di Joint Arab-Islamic Summit 2024 go include plenti key points:

Dem go chook eye for di Israel-Palestinian Conflict, especially di katakata wey still dey go on.

Di summit go torchlight di Gaza and oda plenty mata wey dey worry di Palestinian territories.

Leaders go discuss ways to achieve immediate ceasefire and provide humanitarian aid to pipo wey dey affected in order to end wetin some world leaders describe as humanitarian catastrophe for Gaza, plus emphasis on obeying international law.

Dem go discuss about regional developments wey go also cover di situation for Lebanon and oda regional issues wey dey affect di Middle East.

Dem go take plus establish a unified stance among member states wey concern developments for di region.

Dem go discuss about humanitarian aid wey go strongly emphasize on mobilizing international support to provide humanitarian assistance for di Palestinian people.

Dem go also tok about Two-State Solution wit renewed efforts to revive di two-state solution as di way to lasting peace for di region and dis go be one of di important part of di agenda.

Nigeria president, Bola Tinubu dey travel well-well since in enta office for 29 May, 2023.

E neva tey wen im comeback from vacation wey im go for London.

Nigerians dey expect say all dis travels go bring beta for di kontri and help lives of di citizens.