You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Players wey dem nominate for Professional Footballers Association men player of di year award
Three Arsenal players Declan Rice, Gabriel and David Raya follow for six players wey dem nominate for di Professional Footballers Association men player of di year award alongside Manchester United Bruno Fernandes and Manchester City duo Erling Haaland and Rayan Cherki.
Midfielder Rice, defender Gabriel and goalkeeper Raya dey among di key players for Arsenal as dem win di Premier League for di first time in 22 years.
Former Liverpool winger Mohamed Salah bin win di award last year afta e score 29 times to help di Reds win di Premier League.
Dem go honour di winners on Tuesday, 25 August for di 53rd annual PFA Awards Ceremony for Manchester.
Bruno Fernandes
Bruno Fernandes
Earlier dis month, 31 years old Bruno Fernandes win di Football Writers Association men footballer of di year award.
Dem dey usually use dat award as indicator for who go be di frontrunner wey dem go name di PFA player of di year.
Di Portugal midfielder register record 21 Premier League assists to help United finish third.
E don win two Uefa Nations League trophies for im career wit Portugal.
Im former clubs include Udinese and Sampdoria, Sporting CP and Novara for Italy.
E follow play di 2022 World Cup Wit Portugal
Erling Haaland
Striker Erling Haaland score 27 goals to win di league golden boot.
E follow Manchester City win di English FA Cup and League cup, but carry second for Premier league.
Di 25 years Norwegian go follow play for World Cup dis year.
Harland don dey handle Man City number 9 position since di past four years and don win plenti trophies wit di team.
Bifor e join City, e bin don play for Bryne, Borussia Dortmund and Molde and Red Bull Salzburg.
E don win many golden boot awards for di English Premier League and di Champions League.
Rayan Cherki
Rayan Cherki enjoy successful first season for di Premier League, but e no win di EPL as im club carry second.
E follow Manchester City win di FA Cup and di League Cup.
Di midfielder join Man City for 2025 and dey eligible to play for France for di forthcoming World Cup.
22 years old Cherki don play for Lyon bifor e move to Man City.
Cherki dey eligible to play for France, Algeria, or Italy but e choose to play for di French team wia e don play some matches for dem including di Uefa Nations League.
Declan Rice
Declan Rice enjoy great season wit Arsenal as dem win dia first Premier league trophy in 22 years.
E also play for di 2026 Champions League final against PSG wia dem lose on penalties.
Rice come from Republic of Ireland. E play for di Youth teams of di kontri for major competitions.
But for 2019, e pledge im allegiance to England and feature for di English team against Czech Republic for March 2019.
E bin dey play for Westham United bifor Arsenal sign am.
Rice bin also play for Chelsea youths team for im younger days.
Gabriel Magalhães
Gabriel Magalhães na Brazilian defender wey dey play for Arsenal.
E win im first Premier league title wit Arsenal dis season. E play as major team member wey help Arsenal lift di trophy afta years of waiting.
Gabriel follow play di 2026 Champions League final against PSG wia e fail to score during penalty shootout wey follow make dem lose di trophy.
Though im team lose di trophy, dem name am in di Champions League team of di season.
Bifor e join Arsenal, e bin don play for Avai and Lille.
David Raya
David Raya na Spanish goalkeeper wey dey play for Arsenal.
E follow Arsenal win di 2026 Premier League trophy.
Raya win di Uefa Euro 2024 bifor e follow Arsenal lift di EPL trophy dis year.
David dey for post wen PSG beat Arsenal on penalties during di 2026 Champions League final.
E catch one penalty during di Champions league final.
E bin don play for Brentford and Blackburn Rovers bifor e join Arsenal.
30 years old Raya follow play for Spain for di 2022 World Cup.