Armed robbery for Rivers State university female hostel - Wetin we know

Published

Students of di Rivers State University (RSU) bin protest on Thursday morning sake of robbery incident wey happun for di school female hostel on Wednesday night.

Female protesters claim through some of di placards wey dem carri say di armed robbers rob dem for dia room and allegedly rape dem.

For anoda placard, di inscription read: “RSU, insecurity 5&6.”

But di Student Union Government (SUG) president of di school, Promise Anele wey follow BBC Pidgin tok say di armed robbers no rape anybodi but dem injure di victims.

Anele tok say na four students di armed robber injure and dem don dey stabilised for hospital.

Soye Maxwell wey be di special assistant to Govnor Siminalayi Fubara, also tok say some of di victims of di attack sustain injuries.

E say di armed robbers steal items like laptops and phones from di students, and im don tok to di university management to ensure say dem provide dis items back to di students.

“We understand di economic challenges wey di student dey face sake of di fuel subsidy removal. To add dis go be like adding more financial pressure to dem, so di university management don assure us say dem go take care of dose items,” Maxwell tok.

Maxwell wey tok say im also meet wit di victims of di robbery attack say im suggest preventive measures wey gatz dey in place to prevent reoccurrence.

“Di fence of di university gatz dey raised. E get security tower for back gate of di university wey gatz dey active. We don discuss wit di CSO of di university to increase im manpower and im don assure us,” Maxwell tok.

Di aide tok say im go report to di govnor of Rivers State to make sure say goment partner wit di university management so students dey well protected and secure.

E add say about four victims wey di armed robbers attack don dey stabilised for hospital.

One eyewitness wey be 500-level student of di university and occupant of hostel C say di robbery happun for hostel B.

Di eyewitness wey no want make we mention her name tell BBC Pidgin say she bin dey sleep wen she hear noise immediately di armed robbers enta hostel B.

“I quickly run down from my bed becos I stay for up bunk, and di first tin wey I check na my fone. Becos dis no be di first time wey dis kind tin go dey happun,” she tok.

Di student tok say di armed robbers molest students but dem no rape anybody.

According to her, di last time dis kind tin happun for di school na June, and na opposite her room for hostel C dem rob.

She say pipo don already dey comot for school hostel sake of insecurity and di school authorities don promise say dem go do sometin about am.

“Dis tin don too much and di hostel no dey safe for us again. Pipo dey move out of di hostel. Immediately dat incident happun, one woman come pick her pikin. For now, me sef no dey hostel,” she tok.

She tok say di criminals say dem dey come back and dem dey come for hostel C.

Di Rivers State Police Command for one statement tok say dem receive report of armed robbery attack for di school female hostel and di commissioner of police Nwonyi Polycarp Emeka don order adequate security for di school campus.

Di Rivers State commissioner of police, CP Nwonyi Polycarp Emeka, don call for vigilance and urge students, parents and di school management to take advantage of police control room numbers to report suspicious activities: 08032003514 and 08098880134,” di state police tok-tok pesin Grace Iringe-Koko tok.