Make police give me my pikin body - Mama Onyekachi Ugiri

Wia dis foto come from, Callista Ugiri
Callista Ugiri, mama of 27-year-old Onyekachi Ugiri wey dey live for of Borokiri, Port Harcourt di Rivers State capital dey beg di Rivers State Governor to help her get di deadibodi of her son.
Her son, Onyekachi Ugiri allegedly die after e catch bullet for im head wey police shoot during protest wey some youths bin do against di planned impeachment of govnor Siminialayi Fubara on Tuesday, 31st, October, 2023.
She claim say some policemen allegedly carry di bodi.
How Onyekachi Ugiri take allegedly die
Callister Ugiri say on Tuesday 31 October 2023, one of dia neighbour, Chiwendu come dia house and call her son to join dem for protest in support of di govnor.
"For night afta I don wait and I no see my son, I ask my daughter wia her brother dey, she tell me say our neighbour Chiwendu come carry am and dem two go di protest in support of di Ggovnor.
"On Wednesday, Chiwendu tell my daughter say im carry my son to protest in support of di governor and as police dey shoot, bullet catch Onyekachi, my son on di head. Then my son run enter one building wia e die. Chiwendu run away while police arrest odas wey follow do di protest."
Mrs. Ugiri say as she hear so, she go Old GRA police station and dem tell her to go di headquarters. She go di Control room for Police headquarters and from dia to State CID, all of dem say nobody dey dia.
She also go BMH wia she say she see two pesins wit bullet wound from dat protest, but she no see her son. She go police clinic wia dem say somebody wit bullet wound bin dey dia but she still no see am dia.
End of Di one wey oda users dey read well well
"Dis morning, Friday 3 November 2023 I see video of my son deadbodi wit blood all over. I dey beg di Police to provide di dead body of my son wia ever e dey. I dey also call on di govnorto come to my aid". She tok in tears.

But Commissioner of Police Rivers State, Polycarp Nwonyi say e neva receive any report say pesin die among di protesters wey dem arrest from di protest for di Speaker house on Tuesday 31 October.
CP Nwonyi advise youths not to join political protests or join pipo wey dey go protest for dia own safety, but say e neva receive any report like dat.
"All di pipo wey we arrest for dat protest we don charge dem go court na wetin I fit tok on dat mata." CP Nwonyi tok.
On Wednesday 1 November 2023, Magistrate court for Port Harcourt grant bail of N100,000 to di 120 youths wey Police arrest along with di Chairman of National Youths Council in Nigeria NYCN, Chijioke Ihunwo.
Dis na after Police arraign dem for court on five counts charges wey border on, conspiracy, causing riot, damaging di house gate of di Speaker, Rivers State House of Assembly RSHA, unlawful assembly and causing breach of public peace.
Police bin arrest dem wen some of dem carry protest go di house of di Speaker Rivers State House of Assembly for Old GRA axis of Port Harcourt city.
But about three of dem wey get bullet wounds dey receive treatment for hospital.
Magistrate Gift Amadi wey preside over di mata, grant dem bail after dem plead not guilty to all di charges against dem and adjourn di matter to 5th December 2023 for hearing.
Mrs. Callista Ugiri say she don lodge formal complaint about her missing son for Borokiri Police Station as she dey demand justice for her son.











