Candidates react afta WAEC reopen portal for WASCCE 2025 results

Wia dis foto come from, Olukayode Jaiyeola/NurPhoto via Getty Images
Di West African Examinations Council (WAEC) don announce say di results portal for di 2025 West African Senior School Certificate Examination (WASSCE) results wey dem withdraw sake of technical glitch don dey open again.
According to WAEC candidates fit recheck dia results to see wetin dem get.
Di exam body bin announce say dem dey investigate technical issues inside di recently released 2025 WASSCE results.
So dem bin temporarily deny access for candidates to check di 2025 result for dia portal.
However, WAEC don tok sorry for dia action and beg Nigerians for di mistake wey dem do for di results mata.
"Di result portal don dey open again, candidates fit access am now, check and recheck dia results for di WASSCE (SC), 2025."
"Once again, we truly dey sorry for di wahala and appreciate your understanding and support," WAEC tok for dia post for Friday night on X.
Wetin don change?

Wia dis foto come from, WAEC/X
Afta di announcement of WAEC say dem don reopen di result portal, candidates don begin dey login to check wetin don change for dia results.
Some of di candidates say dia results still dey show dia former grade score, while some say dia own result score don change, afta WAEC do di review.
One candidate post wit screenshot say e own result dashboard dey show 'error' message.
For di screenshot wey e post, di 'error' message say "results no dey available for dis candidate for di specified year and exams diet".
Anoda candidate wey reply to WAEC post for X, say im own 'error' message dey show say e don use im result checker card pass di normal time.
E post im error message wey read, "di card usage don pass di maximum wey dey allowed. Abeg buy anoda card".
Several oda candidates also comment say dia result checker card dey show say dem don reach limit wen be say na only one time dem don use am.
Meanwhile, some oda candidates wey chook mouth inside di result review mata say some of dia results don change.
One candidate lament say her English Language result neva change wia she add say na dat result dey hold her back from admission.
She say she no fit go for admission screening sake of di 'D7' wey she get for her English Language, and upon dat, her card don expire join.
"Noting don dey rectified, my English still dey D7, my card don expire too. Please dem don invite me for screening to study nursing now my English na di only tin wey dey hold me back. I no fit go for di screening wit dis D7," she write for X.
While dis problem no be one sided issue, WAEC expect make dia candidate dey 'check and recheck' dia result portal to see di review wey dem do ontop di results.
Also, some Nigerians don sama knock give WAEC say dat kain issue no suppose hapun as dem get enough time to work on di results.

Wia dis foto come from, X screenshot

Wia dis foto come from, X screenshot
Why WAEC review 2025 WASSCE results
Di national examination body for one statement on dia X account tok say during one internal review, one internal post result release procedure reveal some technical bugs for di results.
Waec bin say sake of di review, dem don decide to urgently review and correct di technical glitches wey lead to di situation, as a result, access to di WASSCE (SC) 2025 results don dey temporarily denied on di result checker portal.
Dem say make pipo wey don check dia result before, make dem go back afta 24 hours to re-check.
Di council say as part of efforts to check examination malpractice, dem bin embark on one innovation (paper serialization) wey di national examination body bin already deploy.
Dem carry out di paper serialization in Mathematics, English Language, Biology and Economics, but one internal post result release procedure bin reveal some technical bugs for di results.
Di national examination body say sake of dat, dem bin get to shut down di result checker portal and try resolve di mata wit "transparency and urgency" within di next 24 hours.
How WAEC candidates perform for WASSCE 2025
Na on Monday, 4 August, Waec release di results of di 2025 West African Senior School Certificate Examination.
But in comparison to previous results, dis na di worst results in five years.
Di Head of Nigeria's Office (HNO) of Waec, Amos Dangut, bin tok say dis year result record 33.8 per cent decrease in performance compared to 72.12 per cent wey dem record for 2024.
"Out of di total number of candidates wey sit for di examination for Nigeria, 1,517,517 candidates, wey represent 77.06 per cent, get dia results fully processed and released while 451,796 candidates, wey represent 22.94 per cent, get one or more of dia subjects still under processing sake of some issues to dey resolved," e tok.
Amos Dangut say Waec don withhold results of 192,089 candidates sake of different reported cases of examination mago-mago.
Dis number represent 9.75 per cent of di total number of candidates wey sit for di examination.
According to Dangut, di figure represent 2.17 per cent decline if you compare wit di 11.92 per cent wey dem bin record for di 2024 edition of di same examination.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 3
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 4










