You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Irish goment want give citizens tax 'giveaways'
Di Irish finance minister don reveal one of di biggest giveaway budget for di kontri history.
Paschal Donohoe tell di Irish parliament say e dey for position to do am because di kontri bin get ogbonge budget surplus.
Most of di surplus dey come from di huge increase in tax collection for corporation, mmostly from small number of American tech companies.
Some of dat money go enta inside "rainy day" national reserve fund.
Oga Donohoe announce income tax package wey worth more than €1.1bn (£963m).
Unlike UK, Ireland no dey borrow to fund tax cuts.
Di minister say im budget go focus on helping families and businesses wey face di cost of livinf crisis wey di effects of di Covid 19 pandemic and di Russian invasion of Ukraine.
E say "as one of di most open economies for di world, we dey benefit wen tins dey go well internationally but wen di bad one happun, we dey most exposed".
End of Di one wey oda users dey read well well
Oga Donohoe bin also say di headline inflation for Ireland dey run at "highs wey we neva see in many decades" add say, di Department of Finance don update di forecast for headline inflation to 8.5% for 2022 and just 7% for 2023.
Pipo go start to pay di higher for 40% rate of tax on income wey pass €40,000 (£35,731).
Dem go give tax credits to home owners for fuel, and tax on petrol and diesel for di pump no go change.
Oda announcement include:
- Electricity credits for household wey reach €600 (£536) , dem go pay for three instalments for €200 (£179).
- For November, dem go add payment of €500 (£447) to those wey dey collect di Working Family Payment.
- Dem go be increase of €12 (£11) per week for those wey dey collect social welfare.
- Price of pack of cigarette go go up by 50 cents (45p)
- Dem go comot VAT pata-pata from newspaper, wey be 9% before
Oga Donahue conclude say plenti risk dey di kontri finances but e conclude say, "we fit and make we dey confident about our future".