You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Record label say Drake lawsuit 'no make sense'
Universal Music Group don sama Drake on im lawsuit ova di release of Kendrick Lamar diss track Not Like Us last year.
Di Canadian musician file di lawsuit on Tuesday wey accuse di company of defamation becos dem allow di song to dey published. Di suit say di song bin spread di "false and malicious narrative" say e be paedophile.
To ansa, Universal say, "dis claims no dey true but also to think am say we go wan harm di reputation of any any artist especially Drake, no make sense". Universal don be Drake label for more dan 10 years now.
Dem also accuse Drake say im wan try "silence" Lamar bicos im carry dia rap battle go court.
Di label tok say, "throughout im career, Drake don sue UMG intentionally and successfully to distribute im music and poetry to take do conventionally outrageous back and forth 'rap battles' to express im feelings about oda artists.
"E now wan weaponize di legal process to silence artist creative expression and to seek damages from [Universal] say dem distribute dat artist music."
To ansa claims say Universal purposely harm Drake career, di label to say, dem don invest well-well into im music as dem help am "achieve historic commercial and personal financial success."
Di statement conclude say, "we neva and no dey do defamation against anybodi."
End of Di one wey oda users dey read well well
Drake file im lawsuit for di US District Court for di Southern District of New York on Wednesday and na di latest chapter on im long term beef wit Lamar.
Di two use rap take sama each oda last year. For one rap track, Drake accuse Lamar of domestic abuse.
Lamar come respond wit Not Like Us wey im call out Drake and im crew as "certified paedophiles" wey dem suppose "register and put dem for neighbourhood watch".
In court documents, Drake claim say Universal bin know say Lamar lyrics na like but "bin continue to fan di flames" of di beef so dem go fit profit.
E claim say di label bin launch campaign "campaign to create viral hit" from di song and suggest say di shooting wey happun near im Toronto mansion last May na directly bicos of dis actions.
Universal, e say, "chose corporate greed ova di safety and well-being its artists."
Di court documents say, "dis lawsuit no be about di artist wey create Not Like Us".
"Instead, na only UMG, di music company wey decide say dem go publish, promote, exploit and monetize allegations wey dem bin sabi say no be true and also dey dangerous."