You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
France 3-1 Senegal: 2026 Fifa World Cup Group I live updates
Second Half
Full Time France 3-1 Senegal
90+8 Match don end
France 3-1 Senegal
Senegal still dey celebrate dia goal wen Mbappe fire shot from outside di box to score France third goal.
90+6 GOALLLLLLLL FOR FRANCE! MBAPEE!
90+5 France 2-1 Senegal
90+5 GOALLLLLLLLL FOR SENEGAL! Mbaye of Senegal wey just enta don score!
90+3 Senegal dey hold ball now but dem neva use am do any tin. Dem try to play shot for France goal area but defenders block am.
90' Referee add eight minutes
88' Senegal dey find goal by all means but France don dey control di match since second half start.
France 2-0 Senegal
82' GOALLLLLLLLL FOR FRANCE, Barcola wey just enta now now don score France second goal. E tip di ball cross Senegal goalkeeper Mendy as di ball enta net.
79' Substitution for France Ousmane Dembele don comot and Barcola don replace am.
76' Double substitution for Senegal, Ibrahim Mbaya enta for Ismaila Sarr, Camara don play finish Habib Diarra enta.
73' France dey find dia second goal but Senegal goalkeeper Mendy block di ball.
France 1-0 Senegal
66' GOALLLLLLLLL FOR FRANCE! Kylian Mbappe score from beta cross wey Michael Olise give am.
64'SAVE! Mbappe of France carry ball run dey go Senegal goal area but Mendy run comot from goal line to catch di ball.
61' NO PENALTY!!!! Afta VAR check referee say NO PENALTY sake of say no contact bin dey between Sadio Mane and Kylian Mbappe.
VAR CHECK! Referee dey go check for possible penalty against Senegal
59' Dinmatch don begin dey hot small-small as Sadio Mane of Senegal bring down Mbappe of France near di goal area.
57' Senegal goalkeeper Mendy dey shine for dis match as e dey block all di goal attempts wey France dey carry come.
55' Nicholas Jackson of Senegal miss anoda chance to score for Senegal, e play di ball land for France goalkeeper hand.
53' France play corner kick but notin come , dis na afta Michael Olise fire shot for Senegal goal area but e hit Eduard Mendy leg enta corner kick.
52' France player Michael Olise ball run go Senegal goal area but defender clear di ball give Senegal player we do counter attack but France defender bring am down near di box.
50' Senegal dey worry France but dem neva fit score, dem dey control di midfield for now.
48' Doue of France fire shot from outside di box but e go wide.
46' Referee don blow whistle, second half don start.
First Half
Half-Time Senegal 0-0 France
45+6 Referee blow whistle, first half don end.
45+6 MISS!!!! Ismaila Sarr of Senegal miss clear chance to put Senegal in front, e play di ball inches away from di roof top.
45+5 France dey play short-short passes, e be like say dem dey use am buy time dey wait for referee whistle.
45+3 Senegal and France just dey carry ball dey run for field, no goal yet.
45' Referee add six minutes.
44' Corner kick for France, Dembele playb am but Senegal defender clear di ball wit im head as e nod am comot.
39' Senegal player Ismaila Sarr fall for ground afa France player match im leg, medical team dey treat am but e don comot from field for now , e go enta again later sake of di new Fifa law.
38' Action neva too dey but Senegal no dey give France breathing space.
30' Ismaila of Senegal miss anoda chance as e ballon di ball go up.
25' CHANCE! Nicholas Jackson miss beta chance to score for Senegal , e make solo run reach France goal area, e fire di ball wey don almost enta net but di ball touch di tip of di goalkeeper leg , di ball just comot go outside di pitch.
22' Midfield choke for dis game France don getv beta chances so far but Senegal defence dey gidigba.
19' Ismaila of Senegal carry ball runn enta France goal area but e play di ball over di bar to di left corner.
19' Dembele of France fire shot but Senegal defender block am.
14' Kylian Mbappe of France get anoda beta pass but im no fit run reach di ball quick as di ball as di ball go out of play.
12' Kylian Mbappe of France give beta pass to Ousmane Dembele wey bin wan score but Senegal defender clear di ball.
11' Action neva too dey as both France and Senegal still dey try settle into di game.
7' Senegal make beta run towards France goal area but defender block di player until Senegal lose di ball,
6' Both Senegal and France no dey allow di ball stay long for dia opponent leg.
4' France dey hold ball in di last one minute but Senegal ready for dem.
2' France get chance near Senegal goal area but Hernandez playbamn wide.
2' Di match start wit plenti energy and ginger.
1' Match don start
Line-up
France starting XI: Mike Maignan (GK); Theo Hernandez, Dayot Upamecano, William Saliba, Jules Kounde, Adrien Rabiot, Aurelien Tchouameni, Desire Doue, Ousmane Dembele, Michael Olise, Kylian Mbappe ©
Senegal starting XI: Edouard Mendy (GK); Kreptin Diata, Kalidou Koulibaly ©, Moussa Niakhate, El Hadji Malick Diouf, Lamine Camara, Pape Gueye, Ismaila Sarr, Nicolas Jackson, Sadio Mane
Time don reach for one of di biggest games for di 2026 World Cup group stage for di US France v Senegal.
Di two-time world champions France dey jam wit di 2021 Afcon champions, di Teranga Lions.
Plenti tins dey at stake for dis group I game, apart from di points, France go dey hope to revenge dia 2002 defeat to Senegal for dat World Cup opener.
Both teams get plenti stars wey go show for dis one, football fans go really enjoy dis one.
Both coaches – Didier Dechamps and Pape Thiaw drop lineup for dis game, Deschamps don select im star boys Mbappe, Olise and Dembele.
Pape Thiaw also select Sadio Mane, Koulibaly, Ismaila Sarr and odas to faceless Bleus.
Dis na chance for anoda African kontri to get point for dis tournament, afta Ivory Coast secure three points versus Ecuador, Morocco get one point against Brazil, Cape Verde collect one point from almighty Spain wey Egypt also collect one point from Belgium.
Oda teams like Tunisia lose 5-1 to Sweden wey South Africa collect 2-0 from co-host Mexico.
Afta 90 minutes we go find which of di two – Senegal and France go carry di three points or if dem also go share one point each.
Buildup
One of di ogbonge games for di Group stage for di 2026 Fifa World Cup go happun on Tuesday evening for New Jersey.
Senegal wey be 2021 Afcon champions go meet former World Champions France for dia Group I fixture.
Di stakes dey high for dis match as di Teranga Lions dey look to get points from France to start dia World Cup campaign for good note.
France for di oda hand go hope say dia star-studded team go sama Senegal.
Di French team na one of di favourites to win di tournament dis year wey dem get plenti ogbonge players wey fit carry dem all di way to di final.
Senegal dey comot di back of disputed 2025 Afcon wey Confederation of Africa football strip from dia hand sake of dem boycott di game afta di referee give one decision against dem wen dem bin dey jam Morocco for di final.
Caf disciplinary board rule say Senegal bin forfeit di game di moment di players waka comot di pitch for protest; even though dem later return to complete di game.
Na so dem bin award Morocco as winners for di Afcon.
Senegal don file appeal for di Court of Arbitration for Sports against di Caf decision wey dem still bin dey call diaserf Afcon champions for di 2025.
France for di oda hand no really get wahala except wetin pundits describe as power play and big egos for di team.
Dem get players like Kylian Mbappe, ballon d'or winner Ousmane Dembele, Michael Olise, Rayan Cherki, N'golo Kante, Tchouameni and odas.
So far, na only one African kontri get all three points against dia opponent (Ivory Coast), di rest Morocco, Egypt, Cape Verde all bin get one point as South Africa and Tunisia chop defeat.
For 2002, Senegal bin defeat France 1-0 for di World Cup opener wey shock many pipo well well, but ova 20 years later, di two teams don transform.
Team news
No fresh injury wahala dey for both teams as all dia key players dey available.
France coach Didier Deschamps dey aim to end im 14-year tenure as coach for Le Bleus wit dia third World trophy, but e neva go dey easy.
Di 57-year-old bin win di World Cup as captain wen dem host am for 1998 wey im win am again as coach for 2018 for Russia.
Im almost win am for di third time for 2022 wen France jam wit eventual winners Argentina, wey win for penalties.
Zinedine Zidane go take ova from Deschamps as coach of di national team but im dey hope to comot on high note wit anoda trophy to become di most successful World Cup coach.
France get di ogbonge attacking players wit Kylian Mbappe, Ousmane Dembele, Olise, Desire Doue, Bradley Barcola and odas.
Deschamps get headache to find who to select for each game.
Defender William Saliba dey back to full training afta im back injury, Jules Kounde also dey fit afta im get knock for dia friendly against Northern Ireland.
For Senegal, dem bin play di qualifiers for di tournament witout defeat wey dem top dia group wit seven wins from 10 games wey dem concede only three goals.
Dem go hope dia form go help dem for dis game; and di oda group games against Norway and Iraq.
Di last time Senegal bin lose competitive game (if you take out di Afcon final against Morocco), na for 2022 wen dem face England.
Di Teranga Lions dey unbeaten for 30 games bifor dem lose dia warm up match to di US wey dem draw wit Saudi Arabia.
For Qatar 2022, Sadio Mane bin struggle wit fitness wahala, but dis time di Al Nassr forward dey ready togeda wit Idrissa Gueye.
Wetin di two coaches tok ahead of di game
Didier Deschamps tok say "e dey important to start well sake of na first game be dis."
Im add say "di last World Cup champions bin lose dia opening game; dat neva stop dem from becoming champions, but ideally to start wit a win na di best possible scenario".
Deschamps explain say "di objective wen you dey approach di first game na to win, to get momentum, na so we go play to win".
Pape Thiaw, di Senegal coach face sanctions afta di Afcon final chaos wit Morocco; di 45-year-old dey target anoda upset against France.
"You go shock if Senegal beat France? For me I neva go dey shocked sake of we get world class players for dis our team."
Pape Thiaw say, "We don qualify for di last three World Cup, we bin reach three out of four Afcon finals, so for me, e neva go be surprise."
"I sabi how hard my team dey work, we go play difficult matches against good teams; dis na World Cup. Evri team don earn dia place," Pape Thiaw explain.