We bin experience system glitch but subscribers go still pay dia debts - MTN

Published

Telecommunication giant, MTN Nigeria don announce say dem experience wetin dem call “system glitch” wey dey affect balance enquiries.

MTN wey give dis announcement on dia social media handle tok say sake of di system glitch, some customers fit don receive error messages wey dey show say dem don clear dia balances.

Some MTN Subscribers bin wake up to see say all di airtime and data dem borrow from di telecommunication company don disappear.

Di subscribers happy well-well as MTN begin trend for social media.

However, di telecommunication company don clear am dis no be di case, as all balances go show di correct figure once dem solve do problem.

Dem say dia engineers dey work to solve di problem.

Many Nigerians, especially MTN subscribers bin express shock as tori begin fly up and down say di telecommunication company don clear dia airtime gbese.

Many of dem enta social media to thank di telecommunication for clearing dia debt.

However, di company send message give pipo wey thank dem say na error as dem go pay back di money dem borrow by dia self.

Wetin be 'system glitch'

According to di knowledge library, system glitch most time na temporary disruption.

Plenty reasons dey cause am, although di most common causes na error, although di most common causes na errors within di operating system, inside a piece of software or problems wey computer bugs or viruses dey cause.

Some glitches fit dey easy to fix. For example, restarting your computer dey okay to fix plenty simple glitches.

Restarting your system clears your memory, shuts down running programs, and most times dey delete whatever combination of factors wey fit don create di glitch for di first place.

Practically, glitches fit take many forms. Your keyboard or mouse fit no dey work well. Plenty reasons fit cause di glitch.