How di world celebrate Good Friday

Wia dis foto come from, Getty Images
For all ova di world, Christians dey observe Good Friday as a mark to celebrate di crucifixion of Jesus Christ.
Good Friday na always di Friday wey dey before Easter and di one for 2024 bin fall on 29 March.
Na Palm Sunday dey first begin di Christian Holy week and e signify di crucifixion and celebration of di resurrection of Jesus Christ.
Di celebration of Easter Good Friday don dey for long and na part of how Christians dey celebrate di death and resurrection of Jesus Christ.
Wetin be Good Friday?
Many pipo believe say Good Friday na di day wey be say dem sacrifice Jesus Christ on di cross. Some dey try do fasting, service and even road show to display how di betrayal and and crucifixion bin happun.
Di Good Friday holiday dey very significant for Christianity and na one of those days before Easter wey some pipo go even act how Jesus die on di cross.
Some churches likes di Catholic and Anglican go hold solemn services and offer prayers to remember di death of dia survive.

Wia dis foto come from, Getty Images
For Nigeria, several churches bin take to di street to show drama of how Jesus bin suffer. Di street drama show a man carrying cross wit blood all ova am and some men dey beat am.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis dey signify how Jesus bin suffer before dem nail am for di cross.
President Bola Tinubu say Easter na very significant moment for di Christian faithful and e ask dem to show love and sacrifice.
Di president add say Nigeria go soon overcome all di challenges wey citizens dey face and plenti good tins go sonn begin dey happun.
Origin of Easter

Wia dis foto come from, Getty Images
According to di New Testament for Bible, na Romans crucify Jesus Christ around 30 A.D. and im die on di cross on a Friday and dem bury am inside a tomb outside of Jerusalem.
Three days later, on Sunday, im rise from di dead, according to Mathew 28:1 - 10.
Christians dey celebrate di resurrection each year on Easter Sunday, afta di 40-day season of Lent.
Lent dey begin on Ash Wednesday and end with Holy Week, wey include Palm Sunday, wey dey remember how Jesus take enta Jerusalem.
Maundy Thursday dey honour di Last Supper, Good Friday dey remember di day dem crucify Jesus, and Holy Saturday na di time of transition between di crucifixion and resurrection.
Easter dey known as Pascha in di Orthodox Church. Pascha na di Greek word for "Passover".
Di Orthodox Church dey celebrate "di eternal Passover from death to life from earth heaven."
Great Lent, di time of fasting wey be di strictest for di church, dey take place for 40 days and end eight days before Easter on Lazarus Saturday—wen Jesus raise Lazarus from di dead, according to Eastern orthodoxy.
Palm Sunday and Holy Week go come follow, as fasting continue until Easter. Orthodox Easter dey always follow di Jewish holiday of Passover.
Many historians, wey cite 8th-century monk and Anglo-Saxon scholar di Venerable Bede for im "The Reckoning of Time," believe say di name Easter ma from Eostre, di Anglo-Saxon goddess of spring and fertility.
E always dey portrayed in drawings surrounded by hares and dey believe say dem dey worship dem during pagan festivals.
Anglo-Saxons bin also reportedly refer to di month of April as Eostre-monath.












