Why Ghana Failatu Abdul-Razak fail to break Guinness World cooking record

Published

Di Guinness World Records (GWR) don release result of di longest cooking marathon attempt by Ghana female chef, Failatu Abdul-Razak wey e do for January.

According to one statement from di camp of di chef, di attempt “no dey successful.”

Chef Faila cook for 227 hours for dis attempt wey trend for di kontri well well for di first ten days in January.

For dat time, im cook ova 2,000 plate of food wia dem distribute some to orphanage and pipo for di street of Tamale for di northern region of di kontri.

Im wan beat di current record of 119 hours 57 minutes wia one Irish chef, Alan Fisher don dey hold.

Bifor di Cookathon, Chef Faila tok say im wan “attempt di record to put Tamale for di map.”

Im also wan promote di local food like Tubaani, Fufu, Fuozaafi, Red Red, Wasawasa and odas.

But afta say dem wait for di assessment of dia evidence by di Guinness World Records, di result don finally comot.

Why Faila GWR attempt fail

For di statement wey Faila team release, dem tok say GWR explain give dem say di attempt “fall short of di strict guidelines by di world records.”

GWR tok say dem “violate rest break rules, na so di attempt no make successful.”

For all di marathon attempts for di GWR, di rest breaks na standard.

Pesin go fit take break for five minutes afta every hour of di activity.

Na so dem also go fit take break for twenty minutes afta every four hours.

If di pesin wey don dey attempt di marathon no meet up with dis rest break rules, na so di attempt go fail.

Guinness world records tok say despite di unsuccessful attempt, dem “commend chef Faila im effort.”

“You for be proud of yourself for wetin you achieve for di attempt.”

Chef Faila react to di result from GWR

Despite say di verdict never go in dia favour, chef Faila tok say im dey grateful for di opportunity.

“I don thank everibodi wey support me for dis attempt. Dis na valuable experience for me as a chef from Tamale.”

Di chef add say im dey “committed to oda tins wey go push di boundaries for di culinary world.”

“Say young woman like me from di northern region do dis tin wey unite my pipo, dat be di joy,” Chef Faila tok.

During im Cookathon, celebrities and oda entertainers travel fourteen hours for road and sixty minutes by flight to di place go support am.

Di Vice President for Ghana, Dr Mahamudu Bawumia, former first lady Lordina Mahama and oda goment officials support am wit foodstuff and cash.

For Chef Faila, di fact say all dis ogbonge pipo travel go support am, na fulfilment.

Chef Faila be di second pesin for Ghana wia im GWR attempt neva be successful recently.

Afua Asantewaa singathon also no dey successful

Afua Asantewaa Aduonum do 126 hours 52 minutes singathon during di Christmas period, she also no dey successful.

Di attempt trend for days wia ogbonge musicians and celebrities for di kontri don go di venue to support am.

But afta two months, Guinness world records write for Twitter say im attempt fail.

For one response dem write say “unfortunately di singathon attempt no dey successful, but we hope she go make anoda attempt soon.”

“We don see how inspirational di attempt dey for im fans,” GWR add.

For di reason why di attempt no dey successful, GWR tok say sake of “rest break guidelines wey dem breach.”

Dem add say dem wish Afua di best for future if im decide to do anoda record attempt.

Oda GWR attempt dey happun for di kontri

Afta Afua Asantewaa and Chef Faila do dia singathon and cookathon, anoda pesin don do speech-a-thon.

Adu Sarfowaa wey be entrepreneur also do im longest speech marathon for 130 hours.

Im do im marathon between 9-15 February.

Adu Sarfowaa don dey wait im verdict.

Na so anoda make up artist, Dela Gomey don attempt di record for di most lipstick application for 30 seconds.

Dela do im attempt on 16 January, wia im apply di lipstick for eight pipo in 30 seconds.

Im too dey wait di verdict.

Na so one chef, Ebenezer Smith also begin im cookathon.

Chef Smith start dey cook on di first day of February, wia im go end on 6 March.

By 4 March, chef Smith don cook for 32 days, wey be 770 hours at di time dis tori don dey publish.

Despite di two unsuccessful attempt so far by Afua and chef Faila, oda pipo still dey try dia hands on oda records for di GWR.

Dem say dem wan attempt di records wey go promote di kontri, wey dem also wan take promote dia own business.