You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Court fix April 3 for ruling on Bolanle Raheem death
One Lagos State High Court for Tafawa Balewa Square for Lagos Island don fix 3 April for ruling in di trial of Assistant Superintendent of Police (ASP), Drambi Vandi.
Vandi na di suspect for di alleged murder of Lagos lawyer, Bolanle Raheem on Christmas Day.
Justice Ibironke Harrison on 6 February adjourn di case for ruling afta di prosecution and defence counsels bin adopt dia final written addresses.
For im final written address on a no-case submission wey im file on 28 February 2023, di defence counsel Adetokunbo Odutola urge di court to dismiss di suit and discharge di defendant. E tok say di defendant no get case to answer.
Di defendant no case-case submission get 20 February 2023 as date wey dey ontop am, while di prosecution reply carri 24 February 2023. Di defendant file one reply on point of law wey get 27 February 2023 as di date wey dey ontop am.
Odutola argued say di ballistic report tok say di gun no match wit di bullet wey dem fire.
E also argue say di Pathologist wey testify mention say di bullet penetrate from di left through di armpit while di prosecution tok say dem shoot di deceased for chest.
Defense conclude say wit dis instances and many more, di prosecution neva establish a prima facie case against di defendant wey suppose warrant am to enta di witness box to defend himself.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di prosecution wey di Attorney General of Lagos State, Moyosore Onigbanjo dey lead, however, file one response and tok say make di defendant come defend imsef for di case.
Di state goment prefer a one-count charge of murder contrary to Section 223 of di Criminal Law of Lagos State, 2015 against di defendant and arraign am for di lawyer death.
After listening to di arguments, Justice Harrison adjourn di matter till 3 April for ruling.
How di mata take happun?
Her death bin attract plenti comments online especially, from Nigerians wey dey always complain about di conduct of di police.
Lagos govnor, Babajide Sanwo-Olu also tok sorry to di family of di late Bolanle and assure dem say dem go get justice ontop di mata.
One Barrister Yvonne wey claim say Barrister Raheem na her boss, say di mata happun under Ajah under bridge as di woman dey return from Christmas service wit her husband.
Di officers be like say dem come from di Ajiwe Police Station, Ajah, Lagos State.
She tok say Barrister Raheem family call am to narrate wetin happun to her and tell am say dem need lawyer sake of di mata.
“Di police officer na from Ajiwe station. Her husband na im dey drive, Barr. Omobolanle sit for front wit her husband,” Barrister Yvonne tok.
“Di officer ask dem to park and dem bin need di vehicle in front to move so dem fit park well, and immediately di police officer shoot at close range right into her chest. Afta dem see wetin happun, di remaining police officers on duty dia run away,” di lawyer tok.
She say afta a while, some policemen bin come move di deadi bodi to di mortuary for Yaba witout consent from di deceased family members.
Who be Bolanle Raheem?
Bolanle Raheem na lawyer, di chief executive officer and lead consultant of Croston Homes Consulting wey dey Lagos, southwest Nigeria.
She be member of di Lagos branch of di Nigerian Bar Association (NBA) and na mother of one pikin.
Bolanle na graduate of Olabisi Onabanjo University, Ago Iwoye, Ogun State.
Di entreprenuer na award-winning realtor wey also dey coach pipo on her line of business.