You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Davido respond to Dammy Krane allegation say e dey owe debt
Afrobeat music star, David Adeleke wey pipo sabi as Davido, don respond to im colleague, Oyindamola Emmanuel, aka Dammy Krane allegation say e dey owe am.
Davido on Friday tok say e neva receive compensation for di three verses wey e contribute to Dammy Krane song nine years ago.
Dis na afta Dammy Krane for one post early dis week bin claim say Davido owe am for dia successful collabo of dia song “Pere”.
Davido come fire back on Friday say e remember times wey e bin provide shelter and sustenance to Dammy Krane for Atlanta, US wen Dammy Krane dey homeless.
"I never get paid for dat, also my 3 verses I don gift you all for your dead career… .. oh yea plus my royalties, we charge now so dat na about $150k x3 per verse.. also house rent and food wen u bin stay for my house for Atlanta wen you dey homeless.” E tok
Wetin Dammy Krane tok
On Monday 23 October, Dammy Krane bin accuse Davido say e owe am moni and no wan settle di gbese.
Dammy Krane, for im social media handle X page bin tok say make Davido pay di alleged gbese sake of im little daughter.
“I know say e hard for rich pipo to pay debts but #davido if no be for my sake, pay me my moni at least for di sake of my daughter (your niece if at all) school fees no easy for Naija now o, na everybodi dey try secure dia future. Na money we want no be wahala o."
End of Di one wey oda users dey read well well
Dammy Krane further say "you no fit get good life if you keep dey support oppression."
E come sama big warning say, "God no dey sleep trust me lol (God dey always awake, trust me)".
Dammy Krane na Nigerian singer wey dey popular for hits like My Dear, Faleela, Catch Fellings and odas.