Nigerian-Americans wey win elections for US

Nigerians wey win elections for US

Wia dis foto come from, Linkedin

Published

President Muhammadu Buhari don promise to dey celebrate di success of Nigerians wey dey abroad (Diaspora).

E tok as e congratulate di eight Nigerian-Americans wey win different seats for di U.S. midterm elections.

Special Adviser to President Buhari on Media and Publicity, Femi Adeshina for statement say President Buhari wish dem sucessful tenure for dia office.

Di Nigerian president also tell dem 'thank you' for dia support and partnerships.

"President Buhari thank dem for dia invaluable support and partnerships, over di years, with groups wey joinbodi with di ideals and objectives of Nigerians in Diaspora associations for di United States".

E pledge im support for every Nigerian wey dey excel for home and abroad.

"President Buhari believe say compatriots wey succeed for good causes na assets to di nation and di continent,".

E say e go always remeber and celebrate dia contributions.

End of https://bbc.com.im/pidgin/articles/cpwzg19v6qgo%3C/p%3E%3C/div%3E%3C/section%3E%3Cdiv dir="ltr" class="css-1k9op6x e17x9cvu0">

Who be dis Nigerians wey win elections for US