Hezbollah leader praise Hamas attack on Israel but say na only 'Palestinian carry out di attack 100%'

Wia dis foto come from, Jamaran
- Author, Kayvan Hosseini
- Role, BBC Persian
- Published
Hassan Nasrallah, leader of Hezbollah, di most powerful political and military force in Lebanon, don break im silence on di Israel-Gaza war.
Over di past month, Hezbollah dey frequently target Israeli armour and military positions from across di border for Lebanon.
For one speech wey im give im fans from one secret location, and wey thousands of of pipo for one rally for di Lebanon capital Beruit bin watch, Hassan Nasrallah praise di 7 October attacks wey Hamas do for Israel wey kill 1,400 pipo.
E say di action of Hamas – wey like Hezbollah, UK and US plus some oda kontris proscribe as terrorist organisations – dey "right, wise and just" but add say dis attack na "100% Palestinian," and dem no get hand inside.
For im speech, im blame di United States, say na dem dey responsible for di war for Gaza.
Nasrallah also thank di Iran-backed forces for Yemen and Iraq.
Houthi rebels for Yemen don dey fire drones for Israel, while Shia Iraq militants dey target US forces for Iraq and Syria.
Iran dey support di so-called Axis of Resistance, one alliance wey include Hezbollah - im most important force – and militants for Iraq, Syria President Bashar al-Assad, Houthis, and Hamas.

Wia dis foto come from, Getty Images
Who be Hassan Nasrallah?
Hassan Nasrallah na Shia cleric wey don dey lead di Hezbollah group for Lebanon since February 1992.
Dis group dey currently among one of di most important political parties for Lebanon, wey get im own armed forces along wit di Lebanese National Army.
Nasrallah, dey popular for Lebanon and for oda Arab kontris and dem consider am di amin face of Hezbollah.
Im play very important role for di history of di group as e turn to political group, enta politics plus gain power for Lebanon goment.
Im get special relationship wit di Islamic Republic of Iran and im leader, Ayatollah Ali Khamenei.
Even though United States list Hezbollah as terrorist organisation, leaders of Iran and Nasrallah no ever hide dis close relationship.
Hassan Nasrallah get many passionate fans just like im get dangerous enemies.
For dis reason, im never appear for public for years sake of fear say Israel go assasinate am.
But say im dey hide no cause im fans no dey hear im speech almost every week.
Dis speech dem na actually Nasrallah important tool for exercising power, and in dis way, im comments on different issues wey concern Lebanon and di world as im try to pressure im rivals.

Wia dis foto come from, Getty Images
Childhood and teenage years
Dem born Hassan Nasrallah for August 1960 for one of di poor neighbourhoods for east of Beirut.
Im papa bin get one small provision, and Hassan bin be im eldest pikin among nine children.
E bin dey five years wen di Lebanon civil war bin start; di devastating battle wey capture di small kontri wey dey for di Mediterranean Sea for 15 years and during dis time Lebanese citizens demarcate dia borders and fight wit each oda base on dia religion and ethnicity.
Di beginning of di war make Hassan Nasrallah papa decide to leave Beirut and return to im ancestral village for southern Lebanon: one village wey dem dey call "Al- Bazouriyeh," like many villages for "Tyre" (Sour)city for "Al- Janub" province, di pipo wey dey live dia na Shiite.
Im spend important years of im primary and secondary education for south of Lebanon, among Shiites.
Shiites believe say during colonial era of great powers like Ottoman Empire and France, dem face discrimination and inequality.
Dis sentiment kontinu during di independence period wen Christian and Sunni elites win power.
During this period, Christian and Sunni militant groups bin chop accuse say im help foreign kontris achieve military success.
At di same time, di Shia population, wey be di majority for South Lebanon plus di Beqaa Valley for eastern Lebanon, wit di one small group of Maronite and Orthodox Christians, bin be di frontline of Israel wars for di long years of establishing Jewish rule for Palestine.
For dat kain environment, Hassan Nasrallah not only turn to im Shia identity and ethnic roots, but at di age of 15, im become member of di most important Lebanese Shia political-military group at dat time.

Wia dis foto come from, Getty Images
Increasing Power and Consolidating Nasrallah Position
As Hezbollah power dey increase, rival groups, especially Lebanese Sunni politicians, insist say dis group don form goment inside goment. And say im activities go make di kontri security and economy weak.
For 2007, after months of political fight fight, Lebanese goment decide say dem dismantle go di telecommunication system wey "Hezbollah" dey control and say make dem give goment total control over telecommunication affairs.
Nasrallah no only reject dis decision, but in short time, im militants take full control of Beirut.
Western kontris seriously criticise Nasrallah. However, after political negotiations,im mange to increase im power for di Lebanese cabinet, and more importantly, im secure di right to veto cabinet decisions.
For 2008, despite say dem reduce Hezbollah seats for Lebanese parliament, Nasrallah manage to retain di right to veto.
Di same year, Lebanon cabinet approved to allow Hezbollah keep im weapons.
From here, Hassan Nasrallah become pesin wey almost no Lebanese political elites fit succeed to remove from di field or even reduce im power.
Di resignation of di prime ministers wey oppose am, plus di unprecedented intervention of Mohammed bin Salman, di crown prince of Saudi Arabia, fit push am back.
Instead, all dis years, wit di support of di Islamic Republic of Iran, Nasrallah dey able to navigate through di historical crises like di Arab Spring, di Syria civil war, and di economic crisis wey dey happun now for Lebanon.
Now at di age of 63, im no only be unique political-military leader for Lebanon but also boasts record of years of struggle.

Wia dis foto come from, Getty Images
How powerful Hezbollah forces dey?
Hezbollah na one of di most heavily armed military wey no belong to any kontri for world.
Na Iran dey maintain and equip am.
Nasrallah say e get 100,000 fighters, although informate from oda source say dem ey between 20,000 and 50,000.
Many of dem dey well trained and dem be odeshi for battle and dem bin fight for di Syria civil war.
E get about 130,000 rockets and missiles, according to Center for Strategic and International Studies tink tank.
Most of im weapon na mainly small, unguided surface-to-surface artillery rockets.
But tori be say e get anti-aircraft and anti-ship missiles, and guided missiles wey fit strike deep inside Israel.
Dis dey much more sophisticated pass Hamas, wey dey Gaza Strip, get.
Hezbollah go go war wit Israel?
Since Hamas attack on 7 October, Hezbollah dey attack military positions for northern Israel.
E launch rockets to Israeli positions, fire anti-tank missiles on armoured vehicles and attack military targets wit explosive drones.
Di Israel Defence Forces (IDF) dey retaliate, using air strikes, tank and artillery fire against Hezbollah positions for Lebanon.
Israel soldiers and Hezbollah fighters don die, and Israel evacuate thousands of civilians from di area.
IDF tok tok pesin, Daniel Hagari, say im forces dey "very high alert" for di Israel northern border.
Di Israel Prime Minister, Benjamin Netanyahu, promise to respond wit "unimaginable" magnitude if Hezbollah open second front for di conflict.









