Man City close gap on Arsenal afta beating Liverpool 4-1

Wia dis foto come from, Getty Images
Manchester City maintain di pressure on Premier League leaders Arsenal by beating Liverpool despite say dia injured striker Erling Haaland no play for Etihad Stadium.
City 42-goal striker no play sake of groin injury, but Pep Guardiola reigning champions demonstrate dia all-round strength by coming from a goal down against a Liverpool side wey bin dey beat dem well-well bifor.
Liverpool catch City wit a counter-attack afta 17 minutes to take di lead, Diogo Jota making di break bifor Mohamed Salah apply better finish.
City respond in devastating fashion wit di outstanding Jack Grealish, wey make ogbonge intervention on Salah wen Liverpool bin waste dia chance to make am two – e cross di ball for Julian Alvarez to equalise afta 27 minutes.
Kevin de Bruyne make two for second half while Ilkay Gundogan add di third goal.
Grealish deserve a goal wey e score on di 74th minute.
Second Half

Wia dis foto come from, Getty Images
90+4mins: FULL TIME
90mins: 3mins of added-time.
End of Di one wey oda users dey read well well
89mins: SUBSTITUTION. Jack Grealish comot for Cole Palmer
87mins: Riyad Mahrez gets on di end of a good pass and from mid-range.
86mins: Konstantinos Tsimikas brings im opponent down and Simon Hooper interrupt di game.
84mins: Manchester City take a short corner instead of sending di ball into di penalty area.
84mins: SUBSTITUTION. Bernardo Silva enta for Rodri
83mins: SUBSTITUTION. Cody Gakpo leaves di pitch for James Milner
79mins: Manchester City players don take full charge of dis game
Man City 4-1 Liverpool
74mins: GOAL! Jack Grealish put di ball past di goalkeeper!
72mins: Riyad Mahrez send a teasing cross into di area, but Alisson intercept di ball.
70mins: SUBSTITUTION. Konstantinos Tsimikas enta for Andrew Robertson. Roberto Firmino replace Diogo Jota, Darwin Nunez enta for Mo Salah
68mins: Riyad Mahrez produce lovely chip pass into di box, but one of di opposition players cut am out. Manchester City earn corner.
67mins: Manchester City players dey exchange short passes wit dem sef. Dem dey gain possession.
65mins: Mohamed Salah deliver promising cross into di box, but dem clear am.
63mins: Riyad Mahrez send a chip pass into di box, but Alisson intercept di ball.
59mins: Kevin De Bruyne produce quality cross into di box, but di opposition defence intercept di ball.
55mins: Cody Gakpo receive pass inside di box and send a dangerous shot in on goal.
Man City 3-1 Liverpool
54mins: GOAL! Ilkay Gundogan score di 3rd for city
52mins: Ilkay Gundogan try to pass di ball into di penalty area but dem block am.
50mins: OFFSIDE. Ref catch Cody Gakpo offside.
49mins: Jack Grealish escape without any punishment from di referee afta using excessive force to foul im opponent.
47mins: GOAL! Kevin De Bruyne make am 2 for City
46mins: Second Half don start
First Half
Man City 1-1 Liverpool
45+2mins: HALF TIME
45+2: We go get 2 mins of added time.
44mins: OFFSIDE against Kevin De Bruyne
43mins: Ref Simon Hooper blow foul against Cody Gakpo.
42mins: Mohamed Salah make a run beyond di last defender, but e enta offside.
40mins: Riyad Mahrez attempt to find one of im teammates wit a fine lofted pass, but di defence react well to block am.
37mins: Trent Alexander-Arnold cross into di box from near di side line
35mins: Simon Hooper blow his whistle afta Rodri kick opponent legs instead of di ball.
33mins: YELLOW CARD for Rodri
31mins: Riyad Mahrez play through ball inside di box, but e too strong and Alisson intercept am.
Man City 1-1 Liverpool
28mins: GOAL! Julian Alvarez equalise for Manchester City.
26mins: Another attempt to send di ball beyond di defence by Kevin De Bruyne dey cleared to safety.
22mins: Riyad Mahrez chop space inside di box after collecting pass, but di chance dey wasted.
Man City 0-1 Liverpool
17mins: GOAL! Mohamed Salah score for Liverpool.
11mins: Rodri gets on end of a pass on di edge of di penalty area and shoot towards di middle of di goal.
9mins: Ilkay Gundogan send a chip pass into di box, but Alisson dey quick to intercept di ball.
7mins: Fabinho trip an opposition player and Simon Hooper signal a foul.
5mins: Manchester City players dey exchange short passes in dia attempt to create a shooting opportunity.
1min: Game don start
Man City vs Liverpool Line ups
Liverpool line up: Alisson, Alexander-Arnold, Konate, Van Dijk, Robertson, Fabinho, Henderson, Elliott, Jota, Salah, Gakpo.
Manchester City Line up: Ederson, Stones, Akanji, Dias, Ake, Rodrigo, Gundogan (C), De Bruyne, Mahrez, Grealish, Alvarez.









