France confam first case of Ebola virus

Wia dis foto come from, Patrick Robert/Sygma/CORBIS/Sygma via Getty Images
France don confam dia first case of Ebola, na one doctor wey just dey return from Democratic Republic of Congo test positive to di disease.
France on Wednesday announce say dem just record dia first case of Ebola and na doctor wey return from humanitarian mission from Congo test positive for Ebola.
Last month, DR Congo announce new case of Ebola outbreak for di kontri.
Ova 1,000 pipo don dey infected wit Ebola and e don kill ova 267, and dis particular trait get di highest number of cases for di first month, according to World Health Organisation
France ministry of health say dem don confam say dis na di first positive case of Ebola virus disease for dia national territory.
Dem don isolate di patient and authorities dey trace pipo wey don dey in contact wit di infected pesin.
France don set up "dedicated monitoring system" for aid workers wey dey return from DR Congo, di health ministry tok.
Di ministry tok say di risk to oda European kontris dey low.
Di current Ebola outbreak na Bundibugyo species of di virus, and e neva get any vaccine at di moment.
Di Africa Centre for Disease Control and Prevention confam di outbreak of Ebola for Democratic Republic of Congofor March.
Di top public health agency for Africa confam di outbreak of Ebola for DRC wit 246 suspected cases and 65 pipo wey die for Mongwalu and Rwampara health zones, for Ituri province.
"Africa CDC dey worry about di risk of di virus to spread more becos of di urban context for Bunia and Rwampara, high population movement, and mining- related mobility for Mongwalu," di statement tok.
Symptoms of Ebola virus and why e dey deadly
Ebola na deadly virus wey im initial symptoms fit include sudden fever, serious weakness, muscle pain and sore throat.
Advance stages fit include vomiting, diarrhoea and - in some cases - both internal and external bleeding, wey dem dey call haemorrhaging.
Di incubation period fit last from two days to three weeks and Ebola fit dey associated wit oda sickness like malaria and typhoid.
Pipo dey catch am wen e get direct contact with dia skin wey get wound, mouth, nose, with blood, vomit, poo-poo or water from di body of pesin wey get Ebola.
Patients dey die from lack of water for dia body and multiple organ failure.
How you fit prevent Ebola virus
Wash your hands evri time wit soap and water - Health pipo say make we wash hands wit soap and water and clean surfaces wit chlorinated water.
No dey touch pipo wey don dey infected - To prevent more of di infection, health professionals advise make pipo avoid contact wit pipo wey dey infected, including for dem to stop to shake hands.
Avoid deadi bodies
No dey kill, touch or chop bush meat
E get vaccine for di Zaire strain of Ebola, wey dey common for di past for Democratic Republic of Congo. And currently no approved vaccine dey for di Sudan strain of Ebola.
Howeva, early treatment of specific symptoms, fit improve survival of di pesin wey get am.
For medical teams, dem must wear full Personal Protective Equipment, PPE, wen dem dey attend to cases to prevent infection. Deadi bodi dem, for any body bag, must dey buried by pipo wey dey wear proper PPE.








