Who go replace Thomas Partey as Ghana jam wit Panama for 2026 World Cup Goup L opener?

Thomas Partey's  appeal was dismissed

Wia dis foto come from, BUDA MENDES/FIFA VIA GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Ghana coach dey likely to use 20-year-old Caleb Yirenkyi for midfield against Panama
Published
Read am in 6 mins

Ghana and Panama go face each oda for di first time for Thursday midnight as anoda African kontri dey try to get good result for dia first game for di 2026 World Cup.

So far eight out of di 10 African kontris bin play one game - only Ivory Coast bin get all three points.

Morocco, Egypt, Cape Verde all don play draw wey dem get one point each. South Africa, Tunisia, Algeria and Senegal all lose dia games.

DR Congo go jam wit Portugal for Wednesday at 5 PM GMT (6 PM WAT) bifor Ghana go meet Panama to also try and get some points later at 11 PM GMT.

But di biggest tori ahead of dis Group L games na di absence of Ghana midfielder Thomas Partey wey lose im court appeal against im visa ban.

Di federal court for di co-host kontri throwey di player appeal against im visa refusal.

Thomas Partey and di Ghana govment file motion to ask Canadian authorities to grant di 33-year-old midfielder "temporary resident permit" make im fit enta di kontri to join di Ghana team to play di match against Panama.

Among oda tins, di motion also ask di court to reconsider di visa refusal by immigration authorities.

But di court dismiss di motion wey dem tok say di player fail to disclose ontop di visa application form say im dey face plenti rape charges for di UK.

For Canadian law, any pesin wey dey face charges, wey chop conviction or prison sentence for anoda kontri no fit enta dia kontri, if di crime im dey accused for, dey carry up to 10 years prison sentence for Canada.

Wit di latest federal court ruling ontop dis Thomas Partey mata, Ghana Black Stars gatz prepare for dia game witout di midfielder wey bin play 58 games for di kontri and score 16 goals.

Ghana has key absences ahead of the group opener

Wia dis foto come from, GHANA FOOTBALL ASSOCIATION

Wetin we call dis foto, Coach Carlos Queiroz say evri game na "must win" game for Ghana

Ghana coach Carlos Queiroz say "my business na to play wit di cards bifor me"

Black Stars coach Carlos Queiroz bifor di latest court decision tok say im prepare wit di players wey dey available for di game.

"We get our plan already, at dis time, we dey count for all di players wey dey available wey we go make decision," Carlos Queiroz tok for pre-match press conference.

Im also add say "to tok about dis Thomas Partey issue no go make sense, e neva be my business. Wetin dey concern me na to play wit di cards in front of me, afta dis decision, we dey ready to make final approach to di game."

"We bin prepare for dis match, di training sessions, di meetings and all di oda tins; we try our best to have di players ready for dis game."

Pundits and football fans for Ghana dey disappointed say one of di kontris key players no go play for dis game.

Already Ghana dey miss key players like Mohammed Kudus, Mohammed Salisu and Alexander Djiku sake of injury - wey now Partey don join di list.

20-year-old Caleb Yirenkyi fit replace Partey for midfield for di game

Ghana coach originally bin select only five midfielders for di tournament - Elisha Owusu (Auxerre), Thomas Partey (Villarreal), Kwasi Sibo (Real Oviedo), Augustine Boakye (St. Etienne) and Caleb Yirenkyi (Fc Nordsjaelland).

Witout Thomas Partey, di coach get only four options to select from.

E dey veri likely say Carlos Queiroz go select 20-year-old Caleb Yirenkyi to partner wit Kwasi Sibo or Elisha Owusu for di midfield in di absence of Thomas Partey.

Di youngster Caleb Yirenkyi na one of di most promising players for di team wey for im club, im dey fit play midfield and defence.

Caleb get pace, wey im fit drive di ball for midfield - in fact di youngster bin score for Ghana against Wales for dia last friendly match bifor di World Cup begin.

Di coach say di team dey ready to "fight for di result" for dis game.

Ghana coach hopes the rest of the squad rally to victory

Wia dis foto come from, GHANA FOOTBALL ASSOCIATION

Wetin we call dis foto, Di 20-year-old fit play for midfield and defence

First time Ghana dey play wit Panama

Head coach for Panama Thomas Christiansen bin agree say Ghana get pedigree for football ahead of di game, but im say im team dey ready to compete.

Di Danish coach say di Black Stars get experience but im players also dey ready to "suffer and endure" to face strong teams.

"We dey confident for oursefs say we fit get positive result, di team dey high spirit."

Panama winger Ismael Diaz say "we dey hungry, we no dey fear anybodi. We want compete wit any team wey we meet, we believe for oursefs."

Defender Jiovany Ramos admit say Ghana na tough kontri but dem go play dia best game.

"Ghana be tough and aggressive, but we go play our part and dey focused and cover di spaces. We know say we go get our moment to score."

Panama bin dey rank 34th for di Fifa World ranking; wey Ghana bin dey 73rd.

In fact for di Group L, Ghana na di lowest ranked team - England dey rank fourth wey Croatia dey rank 11th.

Despite dis, fans and di team managers dey hopeful say Ghana fit give good account of demsefs.

Vice President Prof Naana Jane Opoku-Agyemang bin lead team of govment delegation and di Ashanti King - Asantehene Otumfuo Osei Tutu II, to visit di team for dia base for Toronto to encourage dem.

"Ghanaians back home and oda places around di world dey rally behind you, we dey confident say you go represent us well for dis tournament wit determination, discipline and excellence," Vice President Prof Opoku-Agyemang tok.

She add say "on behalf of di President John Mahama and di govment and pipo of di kontri, I wish you di players and di technical team success for di tournament".

Ghana and Panama don face each oda bifor

Wia dis foto come from, FEPAFUT PANAMA

Wetin we call dis foto, Thomas Christiansen gree say Ghana get pedigree for football ahead of di game, but im say im team dey ready to compete.

Possible Lineups for Ghana v Panama

Ghana XI: Ati-Zigi (GK); Marvin Senaya, Jonathan Adjetey, Jerome Opoku, Gideon Mensah, Caleb Yirenkyi, Kwasi Sibo, Issahaku Fatawu, Ernest Nuamah, Antoine Semenyo, Jordan Ayew

Panama XI: Mosquera (GK); Montenegro,

Rodriguez, Barcenas, Farina, Blackman, Murillo, Waterman, Harvey, Ramos, Andrade

Di game dey happun at 11 PM GMT (12 AM WAT) for di Toronto Stadium for Canada.