Wetin to know about di kidnap gang leader wey dem give chieftaincy title for Zamfara

Wia dis foto come from, Others
Goment of di northwestern Nigerian state of Zamfara don suspend one emir
Dis na afta e appoint one notorious kidnapping gang leader as traditional ruler for im domot.
Im appoint di gang leader, Adamu Aliero ‘Yankuzo as di Chief of di Fulani community (Sarkin Fulani) for ‘Yandoton Daji area
Tori be say dis na part of one peace deal wit armed gangs afta dem agree to lay down dia arms.
But skeptics say armed criminal gangs wey dey behind di wanton killings and kidnappings for ransom for di region no honor similar agreements.
Witnesses tell di BBC say di turbanning ceremony happun on Saturday evening and many goment officials attend and hundreds of suspected bandits come on motorbikes wit no arms.
Many Nigerians don express shock, surprise and anger afta di appointment.
Some pipo say dis one don cast shadow on di fight of di authorities against di armed gangs.
End of Di one wey oda users dey read well well
Sake of dis outrage and backlash, di Zamfara state goment now don suspend di emir of Birnin ‘Yandoto, wey allegedly turban di kidnapping leader and im also dissociate imself from di appointment.
Wetin goment tok
For inside statement on Sunday night, di Secretary to di state goment Kabiru Balarabe Sardauna say dem don set up committee to investigate.
Di committee go investigate di ‘’circumstances wey lead to di action of di emir.’’
But dem no tok categorically tok wetin go fate to di kidnapping leader new chieftaincy title.
Belief be say di gang wey Adamu Aliero dey lead na im dey behind a number of kidnappings and deadly attacks plus one wey dem kill more than than fifty in 2020 for neighbouring Katsina state.
Police bin don declare am wanted but dem no arrest am.

Wia dis foto come from, AFP
Police bin place N5m bounty on Adamu Aliero-Yankuzo
For June 2020, Katsina State Police Command bin declare Adamu Aliero-Yankuzo, Katsina bandits kingpin, wanted, and place moni of N5 million bounty on im head, dead or alive.
Police say dem believe di 47 year old lead bandits operations wey cause many deaths for Katsina and Zamfara states.
Di Commissioner of Police, Oga Sanusi Buba to dat time say anybody wey get useful informate wey fit lead to im arrest make dem report to police.
Buba reveal say di command bin carry out various sting operations afta di Kadisau village attack, wia bandits kill over 20 pipo.
According to am, during di operations, police arrest two bandits, Bello Usman and Usman Sule.
“In di course of investigation, one of di suspects, Bello Usman, confess say e don participate for di attacks and killings for Kadisau village of Faskari and others at Musawa, Matazu, Karaduwa and Yantumaki.
“Di suspect also allege say na Adamu Aliero Yankuzo mastermind di attack, as im dey protest di arrest of im son, Suleiman Adamu Aliero, 24, by di police”.
Di police commissioner say di suspects also confessed say dem don kill several villagers, tiff animals and kidnapp four women during di attack.
Two years later, why dem neva arrest Adamu Alieru?
Di tok tok pesin for Katsina Police Command SP Gambo Isah tell BBC say dem declare Adamu Alieru wanted over two years ago for some killings and kidnappings.
“For over two years now we dey look for am to arrest am for di horrific crimes e commit( allegedly) for Kadisau town wia him and im pipo kill over 100 pipo”.
“Our officers alongside former commissioner Sanusi Buba visit Kadisau to see di massive damage Adamu Alieru and im boys do for dia.”
“Na dat one make us declare am wanted and in fact anybody wey go give us information leading to im arrest go get N5m reward.” Dis na SP Gambo Isah tok.
E also add say no be only Kadisau but dem dey find Adamu for oda similar attacks for some oda towns and villages.
A native of Yandoto village inside Tsafe local goment, e no dey clear at what point Adamu allegedly begin do banditry and kidnapping.
E no dey clear why dem neva arrest di kidnap kingpin but police say dem dey find am.
Why dem give am title of ‘Sarkin Fulani’
According to some residents of Tsafe local goment, di Emir of Yandoto decide to sama chieftancy title on Adamu Alieru because of di role wey e play for peace to reign for di area in di last couple of months.
According to Jamilu Isa wey dey stay dia e don tey wey dia pipo suffer any attack for di area because say Adamu don change im ways and also stop oda group of bandits from attacking.
Isa say e bin support di chieftancy title wey dem give Adamu because to him na something wey go am feel part of di society and make am finally give up on im former ways.
“Di Emir decide to give am dis title simply because of di role wey e play for us to enjoy peace for many months now.”
Shey Goment go revoke title?
Govnor Bello Matawalle special assistant on public enlightenment Bappah Zailani say di issue of revocation of di title dey with di Yandoto palace and pipo in charge dia go do di needful.
E add say goment don do dia own by suspending di emir to show say dem no support wetin happun and dem dey expect pipo in charge of di palace to play dia own part now.















