'We dey question her husband' - Wetin police tok about woman inside di viral 'mummy calm down' video wey allegedly take her life

Published

Di Edo State Police command say di husband of di woman inside di viral "mummy calm down" video dey dia custody.

Dis na ova di death of im wife, Mrs Toluige Olokoobi Babalola wey allegedly take her own life for Benin City.

One of di residents for di area wey dem dey stay wey bin no wan reveal im name tok say di mata shock dem.

E say Mrs Babalola bin dey work as medicine distributor and she and her husband wey be taxi driver and car dealer don dey live togeda happily and nothig dey to show say di woman dey go through hardship.

According to am, tori be say di mama of three bin take her life in front of her one year old pikin.

Di Edo State Police Command PPRO SP Chidi Nwabuzor, while im dey confam dis tori, tok say dem don detain di husband for questioning.

E tok say, "na di husband bin officially report di mata come. E say e just come from market wen e see im wife wey hang with rope for neck."

Nwabuzor add say "na so e hala and call neighbours come and dem follow go hospital and na wia dem confam say true-true she don die."

E say from di hospital na im dem carry am go mortuary and di DPO query am say why e no report di mata to police.

Nwabuzor tok say, "di man still dey with police and go soon dey transferred to di command homicide section of di State CID for further investigation."

Na for 2020, di woman pikin become popular afta im video wia im bin dey tell im mama to calm down as she bin wan discipline am go viral.

Mrs Bababalola tell BBC Pidgin dat time say di event bin change dia life say, "pipo wey be say I no fit expect say I go fit tok to, or I go fit meet, I meet dem."

Dis na as she and her pikin bin meet di Govnor of Lagos State, Babajide Sanwo-Olu afta im use di boy message of calm down for im Salah speech dat year.