Yellow bus drivers for Lagos go boycott work from Monday - Dis na why

Wia dis foto come from, Getty Images
Commercial drivers for Lagos State don warn say dem dey go on seven days protest and boycott of services across di state.
Na sake of allegations of plenty extortion by di management of parks and garages wey dey inside di south west state for Nigeria.
Di Joint Drivers' Welfare Association of Nigeria (JDWAN) tok am for one press statement dem release ova di weekend.
“We dey saddened say despite our dedication to our work, we dey subjected to indiscriminate extortion, violent harassment by di management.”, JDWAN tok.
Di National Leader of di association, Comrade Akintade Abiodun say di multiple levies on di joint drivers by di garage boys and law enforcement agents don cause increase in di prices of food items for Lagos compared wit oda states, as garage boys wey mount road blocks on Lagos road dey put plenty money on consignments wey dey enta di state.
According to am, di drivers lose more than half of dia income to di motor park boys sake of plenty levies for di garage and bus-stops whether dem pick or drop passengers.
Jidwan also complain say dem dey earn dia living through di profession of driving and di trade unions make up of pipo wey no dey make dia money as drivers.
“On a daily basis, we lose half of our income to di motor park boys.
End of Di one wey oda users dey read well well
We pay plenty charges for di garages and for every bus stop wia we dey drop off passengers, whether we pick up passengers or not, we pay morning, afternoon and night.”, dem tok
“Dem leave us wit no choice than to go on seven days protest and boycott services sake of extortion by di management of parks and garages for di state.”, JDWAN add am.
Those wey dey expected to join di strike for one week na drivers of mini buses (Korope), coaster buses federal Mass Assisted Transit.
Wetin be dia demands?
Bus drivers for Lagos say dem no want make di transport union management dey charge dem ‘three passengers money’ afta dem load for parks or for garage. Dem only wan pay money of one passenger per bus.
Dem want make e be say na only Lagos State government ticket dem go collect.
Dem no wan pay motor park thugs for every bus stop. Dem want make goment cancel every illegal money dem go pay afta dem comot for garage and parks.
Dem also want make goment end all harassment on drivers by law enforcement agencies plus intimidation wit guns, cutlass, broken bottles by LASTMA, task force and RRS.
Di drivers association also ask Lagos State goment to provide official bus stop for buses in each community inside di state to avoid unnecessary arrest of dia drivers by law enforcement officers.
JDWAN threaten to carry out more protest for di state and embark on total boycott of services if goment no agree to dia demands.
Meanwhile, di state commissioner of information say dem don begin discuss wit di drivers association and dem go settle di mata.
“E no get any need to panic”, Gbenga Omotosho tok.
“Government don dey look into di mata and dem go return for more toks.”
Im add am say Lagos get ogbonge transportation machinery so if e get any disagreement for one area, e no mean say di whole of Lagos State go dey grounded.
Wetin dis fit mean for residents?

Wia dis foto come from, Screenshot
If di drivers go ahead with dia planned protest, dis fit affect plenti pipo for Lagos.
Di reason be say, dis commercial vehicles na one of di biggest means of transportation for di pipo especially dos wey no fit enta di more tush ones like Uber, Bolts and odas like dem.

Wia dis foto come from, Screenshot
Already, Lagosians ontop Twitter don begin dey express fear of how dem go commute go dia different businesses if di boycott happun.
However, dem dey also sympathize wit di drivers with many saying di money wey dem collect from dem too much.

Wia dis foto come from, Screenshot














