Video show moment woman steal gun from guard and begin shoot

Wetin we call dis Video, Woman steal gun from guard and open fire
Video show moment woman steal gun from guard and begin shoot
Published

Three pipo get injury afta one woman wey guards bin gbab steal a gun from one of di guards and open fire outside one Chilean market on Monday.

One guard and one cameraman dey among di wounded. Dem take di cameraman to hospital wit serious injuries. E dey stable condition, according to national newspaper La Nación.

Di incident happun for Lo Valledor market for Santiago. Dem capture am on a live stream.

Video show as dem escort di woman out of di market in police custody.