Coronavirus: Ernest Boateng lose im pregnant wife to di virus
Published
Mary bin dey work as nurse for di Luton and Dunstable hospital for Bedfordshire, England.
Dem diagnose am with coronavirus for early April and she die one week afta.
Doctors bin try save di pikin for her belle with emergency C-section but her husband, Ernest tok say she no suppose dey work for hospital for di start of di pandemic because she bin get belle, almost to born.
Di Bedfordshire Hospitals NHS Trust tok say: "We dey very sad say we lose Mary. She bin work here for five years and bin dey really loved by our team, she be ogbonge nurse and beta example of wetin we stand for dis Trust".

