How Nigeria dey defend imsef against di spread of Coronavirus- Health Minister

Wetin we call dis Video, How Nigeria dey defend imsef against di spread of Coronavirus- Health Minister
Published

Nigeria Health Minister, Dr. Osagie Ehanire don tok say dem bin dey work hard to find and monitor di contacts of di Italian wey get di coronavirus sake of say make di disease no spread.

"Di Nigeria Center for Disease Control go continue to dey provide tori and new ways dem to prevent di spread." Im tok to BBC

E say goment don put moni plus don beef up surveillance for di four major functional airports for Naija to check di spread of di disease.

Di country confirm im first case on Friday wen one Italian citizen wey been go holiday for Italy, visit Milan come return to Nigeria wit di disease.

So far, dem den deploy sixty doctors to International Airport for lagos and dem don quarantine 28 persons for Ogun state South west Nigeria.

How Resident of Abuja dey react

Dey confirmation of di coronavirus don dey send shock waves plus fear and panic among residents of Abuja.

Many resident of di Nigerian capital now dey wear different shades and colour of nose mask to prevent any kain infection.

Many of dem wey tok to BBC News say dem dey worried sake of say di kontri don get im first case.

Dem say dem dey try follow all di hygiene advise wey goment give to ensure say dem or dia family no get di infection.

Most of dem say dem no feel assured and fear say many odas fit don get di disease dey waka for street

Dem say wetin dey cut dia heart pass na sake of say Nigeria health system dey weak and if many pipo come catch di disease, di authority no go fit handle am.

But the minister insists say wit di four diagnostic testing facilities across the country, no cause for alarm.

How goment di react?

Several hours since dem quarantine di Italian citizen for government own hospital, goment don speed up work to trace all those for im work place, im social network plus those wey e travel wit for plane

Di Minister say di kontri no go also suspend international flights or begin to quarantine travellers.

E say Nigeria's screening capabilities dey adequate to cope with any outbreak.

And also the patient's condition neva get worse to begin stop flight to enta di kontri.

Wetin Doctors dey tok?

Presido of Nigeria medical association, Mr Francis Faduyile say im sef dey fear say medical workers dey at risk since na dem dey di frontline for treatment.

Di minister say even wit all dis, no need for Nigerians to panic as di kontri dey among di Kontries for Africa wey get di equipment and man power to check di coronavirus.

E say di kontri go also work wit neighbouring kontris to ensure say e no spread go dia kontris.