You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
‘I see my son body for Facebook’: Myanmar military torture and kill am
Dis na story about Myanmar refugees wey cross border go India to find refuge.
Dem tell stories of human rights abuses wey Myanmar military commit.
One papa, Joseph, dey mourn di death of im small pikin.
Afta Myanmar military enta im village, im and im 13 year old son Pali Nang run enta jungle, but Pali no make am.
Joseph say, na for Facebook im see im son deadi body and for image wey im see, di body show signs of torture.
But Joseph believe say one day im hope to get justice for im son Pali.
About 40,000 Myanmar refugees n aim run cross border enta India.
Reporting & Editing by Aamir Peerzada, Filming by Faisal H. Bhat, Producing by Rebecca Henschke