You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Coronavirus: Hydroxychloroquine fit protect you from Covid-19?
You fit don see tok tok from U.S. President Donald Trump say im dey take di anti-malarial drug, hydroxychloroquine, as prevention against coronavirus.
No evidence dey say hydroxycholoroquine fit fight Covid-19, and regulators dey warn say di drug fit cause heart problems. No take am without advice from your doctor.
Researchers for Africa and around di world dey test different kain medicines, even hydroxychloroquine, make dem check if e fit help patients wey get Covid-19.
Clinical trials also dey happen for U.K. and U.S. make dem check if hydroxychloroquine fit give any protection to frontline healthcare workers wey dey high risk.