You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Cameroon regional elections: Lockdown fit stop vote for Anglophone regions?
Mayors, councillors and traditional rulers don vote representatives for first eva regional council for complete decentralisation process.
Afta, Anglophone go get house of chiefs for Northwest and Southwest regions.
Decentralisation process dey inside 1996 constitution and na 24 years afta weh goment di finish puttam.
One of de traditional rulers Her Majesty, Ze Jeanne Philomène, Melen chiefdom, weh e vote, glad say president Biya include traditional rulers for decision making.
"Chiefdoms go fit get solutions for dia different problems as chiefs go tok on dia behalf inside regional councils".
But, de kweshion weh some kontri pipo di ask na if lockdown fit stop elections.
Presidential elections, senatorial elections and council elections bin all happen inside lockdown.
For some parts for Northwest and Southwest regions vote di go on inside four days lock down weh separatists declare for stop de process.
End of Di one wey oda users dey read well well
But, for Kumbo de Fon of Nso weh separatists bin kidnap for stop e for vote still go vote, though tight security bi dey.
Den, for up station, for Bamenda councillors and traditional rulers vote.
Councillors and chiefs vote 900 representatives, 90 for each region 20 of dem traditional rulers.
Regional councillors bi stay for office for five years ans stand again for second term.
At de end of de vote, regional supervisory commissions for all de constituencies get 72 hours for publish results.
Cameroon regional elections fit play de magic for solve Anglophone crisis?
Regional elections, de last stage for process for give more pawa to de regions, and elect representatives of house of chiefs for Anglophone regions fit bi de magic weh Cameroon need for solve Anglophone Crisis?
Dis na de kweshion some Cameroonians di ask.
900 councillors for de ten regions di vote for representatives for regional councils and house of chiefs dis Sunday 6, November 2020 for first eva regional elections.
Authorities don present de elections as big step for decentralization process - for give more pawa for regions. Also goment say na major step for solve Anglophone crisis wit house of chiefs for de two regions.
One of de causes of Anglophone crisis weh e don enta number four year, na complain of marginalization, say central goment neglect development for Anglophone regions. So some Anglophones wan more pawa for develop dia own regions laik before 1961 wen deh join La Republic, deh bi get Southern Cameroon house of assembly.
Fon Fobuzi, traditional ruler of Chomba, for Northwest region, di share goment e thinking say regional elections go give de two regions more pawas.
"Na de beginning for solution for Anglophone crisis, na already pawa for run dia affairs and e also help for run oda areas like economic, social and cultural matters", Fon Fobuzi tok.
But, Fanso Verkijika, prof of History weh e bi vote against Southern Cameroons union wit La Republic no gree say de elections go solve de crisis.
"De only tin weh e fit contribute for solve de crisis, na for restore Southern Cameroons House of Assembly", Fanso tok.
De sabi person for history no even see de importance of house of chiefs in relation to Anglophone crisis.
"House of chiefs no go reinstate Southern Cameroons house of assembly, but na attempt for divide Northwest and Southwest,- one pipo- Southern Cameroons before unification", Fanso point out.
Facts about de election
For de Anglophone regions, ruling CPDM na de only party for dis election, meaning deh go win de 180 councils for Anglophone regions.
Some opposition parties laik Cameroon Renaissance Movement of Maurice Kamto bi don boycott de council and now regional elections. Also the main opposition party, Social Democratic Front SDF of Fru Ndi boycott de elections. De reason for de parties na say make goment first solve Anglophone crisis.
D elections go hold wit security concerns and separatists don wan say any chief of mayor weh e try for go vote dey for trouble.
Separatists bin kidnap de Fon of Nso no let e go back for e palace as e no gree resign from regional elections.
Elections Cameroon don already send election all materials for different area, goment give moni for parties weh deh di run for elections.
Election campaign start for September 23 and go end for Saturday night, 15 days to elections.