You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Adeyinka Taufeeq Temitope use YouTube learn how to barb hair, draw Wizkid now e say "I fit carve anything for your hair"
Published
Adeyinka Taufeeq Temitope use YouTube learn how to barber, now e say "I fit carve anything for your hair"
Adeyinka wey be from Ogbomoso, Oyo State for southwest Nigeria learn how to design hair from from di video streaming site [YouTube] afta im oga no allow am touch clipper for di two months wey im be apprentice.
Im tell BBC Pidgin about im dream and wetin im hope to achieve as a barber.
Watch as im draw Wizkid for dis head.
Producer: Ufuoma Gift