You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Eminem still dey alive?: #RIPEminem dey trend afta one tweet, now fans dey fear if Eminem na dead man
Fans of American rapper, Eminem dey worried about di singer afta after #RIPEminem begin trend for Twitter sake of one disturbing tweet from one fan wey dem don delete now.
Concerns about Eminem welfare begin to full twitter afta one Twitter user - wey im account don dey suspended - write: "I don kill Eminem"
As far as we know, di Grammy-award winning rapper wey be 47 years old, and wey im real name na Marshall Mathers, dey alive and well.
Neither im team or Eminem imsef don release anything about e health so far.
n no be di first time death rumours dey fly around about whether Eminem still dey alive.
Upon dat, Twitter don full with plenti-plenti tweets as di hashtag don explode - and dis don make fans dey worried and dey fear onto wetin don really happun to dia singer.