Covid 19 lockdown in Nigeria: Friday prayer go hold today for Lagos mosques afta months of Covid 19 Tasks Force bin lockdown Nigeria

Published
Read am in 4 mins

Muslims go attend di Friday prayer today for mosques inside Nigeria megacity of Lagos afta many months wey goment bin close worship centres sake of coronavirus restrictions.

According to latest update for Nigeria Centre for Disease Control, Lagos get di largest share of di kontri  45,244 confam cases of COVID-19.

Meanwhile Nigeria capital Abuja dey top di toll of coronavirus cases dis morning wit 78 new infections out of di 354 new cases wey di NCDC record last night.

Dis one don bring di total confam cases for di kontri to 45,244.

Di Presidential Task Force on Covid-19 bin down allow di reopening of churches and mosques in di kontri but di Lagos State goment no gree allow worship centres for Lagos to reopen until 7 August.

Govnor Babaide Sanwo-Olu also give rules wey social centre must to obey inside Lagos as dem dey reopen.

Sanwa-Olu say pipo go fit siddon, chop for restaurants now but for dat to happun dem must obey all di health guideline to take reduce spread of coronavirus.

Dis guidelines include;

• Pesin wey no wear face mask no go enter. Pipo for di worship centre and dia leaders must wear face mask.

• Pipo wey no well must not go to place of worship. Di church must to take temperature of all di pipo before dem enter.

• Hand washing tins and hand sanitizers must to dey for di entrance and every oda place.

• Pipo wey dey di worship centre must not pass 1/3 di chairs wey dey church.

• Mark must dey show two meters distance between pipo.

• No form of direct contact must happun. Pipo must no shake hands for church.

• Anytin wey go need make pipo share tins must nor happun. For example, muslims must do ablution for house.

• Dem must disinfect religious houses before and after worship.

•Dem must mark di room to show sign where pipo go siddon on stand wey go maintain social distancing.

•Dem must provide plenty places wey pipo go fit pass to enter or go out so dat pio no go crowd for on place.

•If dem go share food, dem must create plenty places where dem go fit share food.

•Where pipo for fit wash dia hands must dey every door wey enter di room.

•Di organisers must tell di pipo wetin di importance of washing of hands, and put informate about say make dem not touch dia eyes, nose and mouth with dirty hands.

•Dem must to avoid shaking, hugging and oda physical contact.

•Pipo wey get cough or no fit breah well must stay for house.

•Pipo must cover dia mouth and nose with tissue if dem wan sneeze.

Govnor Sanwo-Olu add say make pipo no pass 50 for any gathering.

Nigerian coronavirus cases fit don enta early phase of flattening

Records from di past 48 hours dey show say di rate of coronavirus cases for Nigeria fit don dey slow down.

For di second time di kontri record anoda lowest daily number.

Di Nigeria Centre for Disease Control, NCDC announce three hundred and four new cases wey bring total confam cases to 43,841.

Di previous day (1 August, 2020) di NCDC announce 386 new cases.

According to di latest situation report from di Nigeria Centre for Disease control, NCDC, di kontri don test at least 286,091 samples wit 10 states and di kontri capital Abuja as di places wey still get very high number of cases.

So far Nigeria don discharge at least 20,087 cases and record 888 deaths.

One ogbonge health NGO, Nigeria Health Watch tok say di west African nation discharge rate increase wella wey be say di total amount of active cases don enter early phase of flattening.

For Lagos, Nigeria largest commercial city, wey get di highest number of coronavirus cases in di kontri, di authorities don decide to allow worhsip centres re-open afta dem notice say di number of positive cases don dey reduce.

Nigeria bin first record dia first case of coronavirus for Lagos in on 27 February and since then, di kontri don enta lockdown. Latest ontop di mata be say di president don extend di lockdown for di kontri by anoda one week after di last one di presidential task force on covid-19 bin put, bit expire on 29 July.

Meanwhile as Covid-19 restrictions don dey reduce, World Health Organisation for Nigeria say make pipo dey careful wia dem dey chook head.

Avoid crowd and any small place wey breeze no dey blow well, na wetin WHO advice.