You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Big Brother 2020: See di key rules wey make dis American Reality TV show different from BBNaija
Big Brother United States Season 22 don start on Wednesday night and di title na All-Stars wey include past winners and ogbonge personalities, be contestants for dis season.
Dis na di second time dem go do All-Stars season and di house mates go compete for di grand prize of $500,000. Di first one happun for 2006 and na one Mike Mallin walk away with di moni.
For dis season, di organisers dey take extra care wit di kain contestants and crew wey enta di show sake of di coronavirus pandemic.
Before di reality show bin premiere, host Julie Chen Moonves say she no know who di 16 pipo wey go stay for di house go be but she tok say dem don quarantine di contestants before di premiere.
Chen tell local tori CBSN Los Angeles say 'Dem fly production in "a bunch of pipo, more than 16,"
"Some pipo I tink say dem go go into di house bin test positive for Covid-19, so dey no fit go in," Chen Moonves tok.
Wetin make Big Brother US rules different from Big Brother Naija dis season?
Big Brother America start on Wednesday night and alredi, housemates don dey chop punishment as dem fail for dia Head of House task.
Dis na di other rules wey make dis season different:
End of Di one wey oda users dey read well well
- Dis Big brother America season 22 no go allow make housemates hug demsefs sake of di coronavirus palava unlike Bbnaija lockdown wey dey allow hugs and housemates don even dey engage in relationships.
- For screen, wen dem evict any housemate, social distancing go mean say no more shaking of hands and dem no go fit hug di host. But for BBnaija lockdown, housemates dey hug demsefs wen den evict but dem no dey hug di host, Ebuka Obi-Uchendu, unlike before.
- Dem go reveal New rooms in di house, and each room go bring some kain twist wey neva happun before to di game. BBnaija also get im own new room but na for di HOH and im deputy.
- D first room dem go reveal go be di Safety Suite and dem go give each housemate VIP pass to di Safety Suite. But wetin go dey di mysterious room, and how di whole VIP pass go work? Fans go need to find out.
- Production staff wey dey important to di show, go wear masks and dem go take weekly Covid-19 tests. Na only di show host no go wear mask except wen dem wan show advert.
- Di Crew go also wear ropes wey get color-code for neck and only for areas wey dem mark with dia color.
- All-Stars crew and staff go do regular testing and symptom screening plus PPE requirement. Dem go also bring one Covid-19 compliance officer for di set to dey enforce and monitor say dem dey follow di Covid-19 rules.
Big Brother season 22 suppose start in June, as per di tradition, but dem delay am sake of Covid-19 pandemic.
As coronavirus still dey affect US, di Big Brother production team dey take safety protocol serious to make sure say di All-Stars housemates dey safe.