Coronavirus lockdown: Why Eti-osa, Mainland and Ikeja LGAs for Lagos dey lead wit di highest number of Covid-19 cases for di state

Published

Lagos state, southwest Nigeria, be di epicentre of coronavirus for Nigeria as di state get di highest number of cases recorded in di West African kontri. As at Friday, 31 July, 2020, Lagos alone get 15,042 cases out of di 42,689 cases wey dey di whole kontri.

Of di cases wey dey Lagos state, Eti-Osa local goment area be one of di areas with high number of pipo wey don catch di virus, according to wetin Presidential Task Force (PTF) on Covid-19 tok.

Theresa Enibokun, one public health specialist wey follow BBC pidgin tok, say areas like Obalende na commercial centre and e dey high risk sake of say pipo dey mingle and plenty pipo dey likely to gather for dia.

"Lagos get highest number of COVID cases because of di level of commercial activities for di area." Higher level of visitors, movement, interactions fit be di cause of why number dey increase for di state, according to wetin Enibokun say.

Ikoyi-Obalende Local Council Development Area dey under Eti-osa local goment and di chairman, Fuad Atanda-Lawal, tell BBC pidgin say dem neva record any case of coronavirus for Ikoyi-Obalende area at all and dem still dey sensitize plus do everything to ensure say di virus no reach di area.

He say dem dey do sensitization and dey share face masks and hand sanitizers for pipo wey dey di area but say dem no go fit force pipo.

"We dey tell pipo make dem wear dia face mask and observe social distancing sake of make dem no catch coronavirus but we no go fit force pipo," Fuad tell BBC Pidgin.

Oga Fuad also add say dem don take different different kain programs to di different areas for di grassroot to tell pipo say if dem no wear dia facemasks, dey fit catch am and e fit lead to death.

Im tok say during lockdown, dem feed about 1000 pipo everyday plus di dry food wey dem donate wit some joinbodi private pipo,

BBC Pidgin waka Obalende, wey be one of di areas under di local goment and observe say plenty pipo no wear dia face mask and dem no dey observe social distancing.

Ugochi Obidiegwu, safety profession, blame di high number for Lagos and some areas for di state on lack of enforcement. She say sake of say di pipo no dey obey safety rules wey health authorities and goment don put for ground, di number of infection go dey go high.

"Pipo already sabi wetin to do but dem dey do anyhow sake of say nobody dey make dem do di right, dem dey do anyhow. Even though pipo don hear, dem never still believe say coronavirus no dey real," she tell BBC Pidgin.

Di local council chairmo also say pipo for some areas like Obalende no too believe say di virus real. Im add say some of di pipo no dey live for di area, say dem dey only come to sell market, "di residents dey inside and we don share face mask give dem and educate dem on measures to dey safe for covid-19".

Obidiegwu say goment need to see say pipo obey di rules wey go keep dem safe if di number must reduce.