'Civil defence officer stab and kill my police husband for Lagos'

Published

Mrs Philomena Mgbekem tell BBC Pidgin how one civil defence officer stab and kill her husband wey be police officer.

Di father of three, Edward, don serve wit Nigeria police for 18 years before death meet am as im dey on duty.

She tok how di death of her husband dey affect her and her children.