Coronavirus: Wetin dey cause dis increase in cases afta lockdown for Nigeria

Published

Even as Nigerians dey hala on top di number of new cases for di kontri, afta di national lockdown, di Federal Minister of Health, Dr Osagie Ehanire don explain why e dey happun.

For interview with BBC Pidgin, im tok say di way dem don start to enta communities to dey do testing dey make am so.

But anoda reason be say pipo still neva dey obey di socail distancing rule and some pipo don dey feel like say dem go fit reinforce lockdown even as e don reach di most number of cases since di virus enta Nigeria.

Oga Osagie Ehanire say one of di solution dey di hands of community, religious leaders and tori pipo because na dem go educate pipo say goment rules dey dia for dia own benefit.

"Wearing mask, doing social distancing and to avoid crowds, if pipo do am well, e go give us di kain results we dey expect," oga Osagie bin tell BBC Pidgin.

Di minister tok say anoda total lockdown dey di hand of di president after dem don review di lockdown ease afta two weeks, before dem go decide what next to do.