You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
National grid collapse: Wetin cause nationwide blackout just two weeks into 2020
Nigerians no fit bear di shock say light no dey for all ova di kontri just as dem dey enta 2020 .
Words like 'NEPA' and 'national grid' come begin dey trend for social media as pipo dey express dia feelings about electricity providers.
Di Transmission Company of Nigeria (TCN) bring out statement to explain wetin happun say na di national grid collapse on Thursday wey come lead to nationwide blackout.
"E get one system disturbance wey happun around 12.34pm dis afternoon, and e affect some parts of di kontri."
"As at 1:10pm, we restore back supply to Abuja and most of di areas wey dis disturbance affect .TCN still dey work to completely restore and stabilise di national grid."
Meanwhile, electricity providers all ova di kontri don informate dia customers about wetin happun and ask dem to bear with dia companies.
Eko Electricity Distribution Company for Lagos explain dis blackout wey affect Lekki, Ibeju and oda areas around dia.
Ikeja Electric for Lagos also give dia customers update and thank dem for dia understanding.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis na how Nigerians for Twitter react to di news of national grid collapse and di blackout wey happun for all ova di kontri.