You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Ugandan tori pesin win Komla Dumor award dis year
Ugandan Investigative reporter and newscaster, Solomon Serwanjja don win di 2019 BBC World News Komlar Dumor Award.
Serwanjja na presenter for Uganda NBS TV, wia im dey host one of di stations top shows.
E don also produce award-winning reports, wey include one wey im join BBC African Eye to do illegal sale of melecine,
Di award dey to celebrate Komlar Dumor, wey be presenter for BBC World News wey die suddenly for 2014 at di age of 41.
Serwanjja go be di fifth winner of di awards as im dey follow Waihiga Mwaura, Amina Yuguda, Didi Akinyelure and fellow Ugandan Nancy Kacungira.
As part of im prize, e go go London to spend three months for BBC dia, before e come back Africa to report tori here.
Im na tori pesin wey pipo sabi on top how e dey totori am to do investigative tori wey dey interest of Uganda pipo.
Serwanjja tok say, "Komla way im det tell Africa tori na breath of fresh air as im see Africa as rising and bin want make di world see am like dat. I wan continue im legacy by say I no go oly tell tori of Africa for dia bad times but also di kain success dem dey make."
Serwanjja impress di juges with im passion to tell African tori but also im bravey to comot tori wy dey public interest.
Jamie Angus, wey be di director of BBC World Service Group, tok say "To find and back Africa leading talent for journalism, in honour of Komlar, dey important for us.
"Tori wey Komla bin tell tori wey impact audience for all ova di world, and e dey totori us for BBC say we don get Solomon, to fit get Komla commitment to tell African tori."